BBC Pidgin of Wednesday, 17 September 2025

Source: BBC

Video capture workers dey jump storey building sake of fire incident for Lagos

Workers dey jump high-rise building sake of fireoutbreak Workers dey jump high-rise building sake of fireoutbreak

Many workers bin dey trapped afta fire break out for Afriland Building on Broad Street, Lagos Island, Lagos, on Tuesday 16 September.

Different videos wey dey circulate on social media show moment workers dey jump from window to escape di fire.

Di fire draw immediate attention as thick smoke and flames rise into di air as pipo bring out dia phone to record di moment.

Emergency services don dey mobilised to di scene to contain di fire.

Inside one of di videos, one man dey climb down one ladder from di building as odas hold di ladder for am.

E no clear wetin cause di fire as at di time of filing di report.

Authorities neva confam weda anybodi die.


Ogabi Olajide wey be di Deputy Controller General of Lagos State Fire and Rescue Service say dem dey currently battle di fire.

Olajide say dem bin receive distress call at 13:38 hours, and Fire crews from Ebute Elefun Fire Station and Sari Iganmu Fire Station bin respond.

'Di fire start from inverter room' - Fire Service tok

According to Ogabi Olajide, di fire originate inside di inverter room wey dey located for di basement of di building while smoke don spread across multiple floors and engulf di structure.

"Evacuation of occupants dey in progress, while firefighting operations don dey concluded dousing di earlier panic bifor di arrival of di first responders," Olajide tok.

Inside one of di videos wey dey circulate on social media, one man dey climb down from di building as odas hold ladder for am.

Afriland na open-office setting wit floor-to-ceiling windows wey dey overlook Marina district.

According to DCF P.O. Abraham wey be di National PRO and Head of Corporate Services for di Federal Fire Service, dem quickly begin dey rescue di occupants wey dey di building as dem launch firefighting operations to contain di fire blaze.

E say na dia help bin stop di fire make e no spread go oda places.

UBA react to fire incident

United Bank for Africa wey be one of di occupants of di building say dem dey aware of di fire outbreak for di high-rise building for Broad Street, Lagos Island, wey "house one of our many branches".

Dem also debunk di social media claim wey say di fire outbreak happun for UBA House, Marina, wey be dia head office.

"As against report online and social media, di affected building no be di UBA House, Marina, di bank head office," UBA write on dia official X account.

Oda times fire don happun for Lagos

31 January 2024

Heavy fire bin burn down popular Lagos church wey dey known as Household of David wen workers dey setup for programme.

Household of David church dey located for Adeniyi Jones, Ikeja Lagos wia di conference suppose start by 5pm same Wednesday evening.

One eyewitness wey dey bifor di fire begin tok say evriwia for di church don dey set bifor di fire begin from di roof kon burn di entire building.

April 2024

For April 2024, nearly one week afta fire burn down Dosunmu market for Idumota, one popular market for Nigeria biggest commercial city, Lagos state, affected victims still dey count dia loss.

Goods and property wey worth billions of naira of burn for di fire.

March 2022

For March 2022, BBC News Pidgin capture fotos from di scene of di fire outbreak for Ebutte Ero market, Apongbon under bridge area of Lagos State, southwest Nigeria.

Reports say plenti shops wey dey under di bridge na im fire bin destroy.

November 2022

For November 2022, report of fire outbreak for Victoria Island part of Lagos State, southwest Nigeria, bin show.

BBC Pidgin reporter visit di scene and report say di police bin clear and also condone off di scene.

Di state police command confam say dia vehicle dey involved for di fire incident and say some pipo die and some officers also dey injured.

February 2021

For February 15th 2021, fire fighters from di Lagos State Emergency Management Agency (Lasema) quench one fire outbreak for one warehouses filled wit flammable items for Iddo Train Terminus, Ebute Matta.

Di Director-General of Lasema, Olufemi Oke-Osanyintolu say na power surge wen electricity dey restored for shanties behind di terminus cause dat one.

March 2021

For March 21 on top Otedola bridge, fire burn down vehicles again for Lagos dat Saturday morning.

Lagos State Fire and Rescue Service say one 45, 000-litre diesel tanker accident opposite di Otedola Estate main gate for cause one heavy fire but e destroy six oda motor.

But di main cause of di fire still dey under investigation.

May 2021

For May 2021 anoda fire outbreak happun for Oshodi market.

Fire-fighters bin battle to quench fire wey burn for Cairo market for Oshodi, Lagos State, southwest Nigeria dat night.