You are here: HomeAfricaBBC2023 10 04Article 1856456

BBC Pidgin of Wednesday, 4 October 2023

Source: BBC

Victoria Beckham open up on her husband alleged affair

David and Victoria Beckham David and Victoria Beckham

Victoria Beckham, David Beckham wife don open up about her husband alleged affair wey go viral.

She describe am as di "hardest period" of dia marriage.

Di couple bin don deny claims say David bin get affair wen e dey play for Real Madrid for 2003.

"Dat time na di hardest period for us because e feel like say di world dey against us," di former Spice Girl tok for one new Netflix documentary.

"Here na di tin - we bin dey against each oda if I go dey completely honest."

For di documentary, dem title Beckham, wey dem release on Wednesday, di couple no discuss details of wetin really happun.

But Victoria tok say: "You know, up until Madrid, sometimes e go feel like say na us against everybody else. But we dey togeda, we dey connected, we get each oda back.

"But wen we dey for Spain, e no really feel like say we get each oda. And dat one dey sad."

She continue: "I no even fit begin tell you how hard e be and how e affect me."

Victoria tok about di paparazzi wey bin follow she and her children wen dem move go join her husband for Spain, she add. “Na nightmare. everywhere we go press dey follow us."

Wen dem ask di singer-turned-designer if she hate her husband during dat time, she reply say: "If I go dey totally honest, yes I did.

"If I wan dey honest, na di most unhappy I don dey for my entire life."

For di series, di ex-England and Manchester United midfielder – wey now be di owner of Inter Miami - also tok about how di rumour about im extra-marital affairs affect im and im family.

"Some horrible stories dey wey bin dey difficult to deal wit," e tok. "Dat na di first time dem go put me and Victoria for under dat kain pressure for our marriage.

"I think two of us bin feel at dat time say, we no dey lose each other, but we dey drown."

E add: "I no know how we get through am, in all honesty."