BBC Pidgin of Thursday, 9 October 2025

Source: BBC

Uche Nnaji - oda public office holders wey enta certificate scandal

Nigerian public officers wey enta certificate scandal Nigerian public officers wey enta certificate scandal

Di certificate scandal of Nigeria Minister of Innovation, Science and Technology, Geoffrey Uche Nnaji and im resignation don raise serious kwesions and fresh reminders of odas wey don enta same gbege bifor.

Oga Nnaji certificate scandal make am tender resignation to Nigeria President Bola Tinubu on Tuesday 7 October 2025.

For August 2023, President Tinubu name Uche Nnaji among di first batch of 28 ministerial nominees from 25 states, and e forward im name go di Senate for screening and confamation.

Di Senate confam Nnaji as minister afta e appear bifor dem wit im educational qualifications and certificates.

But dem no torchlight any case of forgery for im certificate until 2025 wen one investigation wey Premium Times Newspaper publish allege say di minister no complete im complete university education, and say both di bachelor degree and National Youth Service Corps (NYSC) discharge certificate e dey parade up and down na fake.

Despite say di Department of State Services dey among dose wey follow for di ministerial screening, dem no spot any case of certificate fraud, and dis dey raise di kwesion of how Uche Nnaji take sail through di screening.

Meanwhile, di Nigeria Minister Uche Nnaji bin deny di allegations say e forge im degree and National Youth Service Corps (NYSC) certificates, say na politicians for im state dey blackmail am.

But President Tinubu through im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, say di resignation of Nnaji na sake of di certificate scandal wey dey hang for im neck.

Oda political office holders wey enta certificate scandal for Nigeria

Kemi Adeosun

For 2018, Nigeria goment confam say di den Finance Minister Kemi Adeosun don resign afta almost three years for office.

Wetin cause Madam Adeosun to resign na becos dem find out say di National Youth Service Corps (NYSC) certificate wey she use qualify to become minister na fake.

Dat time, na late President Muhammadu Buhari be di president and she feel say her position for office go cause wahala for di President campaign for di 2019 elections.

By September 2018, President Buhari bin accept di resignation letter of di den Minister of Finance, Adeosun.

Di allegation against Adeosun dat time na say her NYSC certificate na fake, but still, she pass through di National Assembly for ministerial screening.

Na dat same NYSC certificate wey she take work for Ogun State House of Assembly in 2011 and also use am for 2015 for Directorate of State Services (DSS) clearance.

Wen di noise bin loud afta PremiumTimes release dia investigation on top di certificate scandal, Adeosun gatz resign, but we no hear of any prosecution.

Salisu Buhari

Dis particular tori bin rock Nigeria for di 1999, wen Salisu Buhari bin enta gbege sake of certificate scandal.

Salisu Buhari na di Speaker of di House of Representatives for Nigeria dat time, and e serve from 1999 reach 2000.

Afta e enta office, wahala sup say di age wey e dey use and im educational qualification na fake.

E bin claim say na from di University of Toronto e bin graduate, but na diploma e get and na dat controversy make am resign as Speaker of di House of Reps.


Biobarakuma Degi-Eremienyo

One event turn for 2019 wen di federal high court for Abuja bin disqualify di den Bayelsa State deputy Governorship Candidate for All Progressives Congress (APC), Sen. Biobarakuma Degi-Eremienyo say e no go participate for di governorship election wey hold for Saturday 16 November 2019.

Di reason why di court disqualify Sen Degi-Eremienyo na sake of say di information wey e fill for di electoral form, dem say wetin e submit give Independent National Electoral Commission (Inec) to contest di election no correct.

Court say di name wey di politician bin submit for im documents no tally for im first school leaving certificate, im first degree and Masters degree and di affidavit wey e swear to correct all im name as all di documents get different different names.

Degi-Eremienyo na di running mate of David Lyon, wey win di Bayelsa State govnorship election for November 2019.

But wen Lyon bin win di election, di court strike am out say im running mate bin get fake credentials.