BBC Pidgin of Friday, 17 January 2025

Source: BBC

US sanction Sudan army chief Burhan ova death of civilians

US government don impose sanctions on di head of Sudan army and de facto president, Gen Abdel Fattah al-Burhan.

Na im dey lead one of di two sides for di 21-month civil war wey don kill tens of thousands, uproot ova 12 million and push di kontri to di edge of famine.

For inside one brief statement, di US treasury department bin accuse Gen Burhan say e "destabilize Sudan and undermine di goal of democratic transition".

Di announcement dey come afta reports of di killing of civilians for di central city of Wad Madani in recent days, however dem no mention am for di statement.

Sudan foreign ministry don dismiss di sanctions as "immoral".

Last week, Mohamed Hamdan Dagalo, US also sanction di head of di paramilitary group wey dey fight di army.

Di US bin accuse Dagalo Rapid Support Forces (RSF) say e commit genocide during di conflict.

As dem announce di sanctions on Burhan on Thursday, Washington tok say di army wey dey under im command "don commit deadly attacks on civilians" including targeting "schools, markets and hospitals".

Di US also allege say di army dey "responsible for di routine and intentional denial of humanitarian access, using food deprivation as a war tactic".

Di sanctions freeze any assets di Sudanese leader get for di US and also block US transactions wit am.

Di Treasury Department don issue exemptions for humanitarian goods, but aid groups fear say di army fit retaliate by further blocking assistance.

During di first year of di conflict, Secretary of State Antony Blinken tok say di army don commit war crimes.

Earlier, Gen Burhan bin order investigation into allegations say im sojas carry out widespread atrocities afta dem recapture di capital of Gezira state from dia paramilitary rivals.

Im move come afta widespread concern say civilians – wey include foreign nationals – die afta di seizure of Wad Madani.

Neighbouring South Sudan on Wednesday tok say dem don summon Sudan ambassador to protest against "di loss of lives among our innocent citizens".

Wad Madani, wey be 87 miles (140km) south of di capital, Khartoum, bin fall to di hand of RSF about one year ago. Di military regain control of am on Saturday.

Di city dey serve as strategic crossroads, wey connect several states through key supply highways. E also be di closest major town to Khartoum.

One Sudanese rights group don accuse di military say dem kill at least 13 pipo for Camp Taiba, one village wey dey about 20km away.

UN humanitarian chief for Sudan, Clementine Nkweta-Salami, tok say she dey deeply concerned about reports of retaliatory attacks against civilians for Gezira "based on alleged affiliation or ethnicity".

US special envoy for Sudan Tom Perriello bin call di reports "terrible" and e urge di army and allied groups to investigate and hold those wey dey responsible accountable.

Gen Burhan tok say im don set up committee to torchlight di alleged killings in Camp Taiba, and don ask dem to report back within a week.

E no comment about di concerns wey South Sudan raise, and weda di investigation go focus on alleged atrocities elsewhere for Gezira.

South Sudan foreign ministry say dem don receive "comprehensive report" from dia embassy for Sudan wey give "detail di unfortunate events wey lead to di loss of lives among our innocent citizens, wey maintain non-combatant status".

Di military don bifor now accuse di RSF of hiring South Sudanese as "mercenaries" to fight on dia side.

Social media videos of various incidents don spread online, including one wey show as dem throw one man wey wear civilian cloth ova one bridge, and a group of men begin shoot am.

BBC Verify confam say dem feem di video along Hantoub bridge ova di Blue Nile river.

We don match key elements for di video, wey include di railings plus di painting wey dey di railing, as e show for di video to earlier videos wey dey feem for di bridge.

One of di men wey follow for di incident, and dey carry one Sudanese flag, wear cloth wey get one logo wey al-Bara'a bin Malik Brigade dey use. Al-Bara'a bin Malik Brigade dey fight alongside di Sudanese army in Khartoum and neighbouring states.

Two oda videos wey dem feem for anoda place show as dem lay dem for ground, face one wall, dead body of at least 30 men wey wear civilian cloth.

BBC Verify don establish, through matching objects wey dem see for video wit satellite imagery, say dem feem di video for one location north-west of Wad Madani, wey be just a few metres from wia e be like say di army bin ambush RSF fighters.

E neva dey clear how di men die and weda dem don kill dem bifor dem gada di bodies for there.

E also no dey possible to identify dem or know weda dem dey affiliated to any of di fighting parties, as e dey common for armed fighters not to wear uniforms.

Videos of di ambush, heavy exchange of fire, and di aftermath also dey trend for social media.

Di Sudanese armed forces on Tuesday bin condemn wetin dem call "individual violations" for some parts of Gezira state, and promise say dem go hold those wey dey responsible accountable.

Di RSF chop accuse say dem carry out retaliatory attacks for Gezira afta dia commander Abu Aqla Kaikal defect for October last year.

Kaikal bin dey heavily involved for di operation wey lead to di army wrestling back control of Wad Madani.

Additional reporting by Yussuf Abdullahi and Barbara Plett Usher