United States of America passport don drop from di position e belong for di top 10 in di last 20 years to 12th position, according to Henley Passport Index ranking.
Di Henley Passport Index use di data by di International Air Transport Association (IATA) to rank 199 passports based on dia strength to travel to 227 kontris without visa.
Henley Passport Index, rank di passport base on how many kontri, you fit visit visa free wit your passport. US passport dey rank 12th globally wit Malaysia passport currently.
For 2024, US passport bin place for di seventh place, before e move to 10th position for July of dis year. But now for October, e no longer dey among di list of 10 most powerful passports in di world.
Di Chairman of Henley & Partners and creator of di Henley Passport Index, Christian H Kaelin tok say di recent drop in di US passport from di top most powerful passports na becos of di global power shift
"Di reducing strength of di US passport ova di past decade na more dan just reshuffle in di rankings – e signal fundamental shift in global mobility and soft power dynamics," e tok.
American passport holders fit travel to only 180 kontris visa-free, e fit be becos of visa restrictions wey US place on some kontris, becos US only allow 46 oda kontris to enta without visa.
President Trump don issue visa restrictions to 12 kontris in Africa, Middle East and Southeast Asia and threaten to ban more kontris from Africa from entering US. Seven kontris in Africa now go need visa bond of USD 5,000 to 15,000 now, refundable only upon departure bifor dem go fit get US visa.
Also, di UK passport don fall from 6th position to 8th position from di last review in July.
Currently, na Asia kontris dey dominate di ranking wit Singapore at di top of di list wit access to 193 kontris without visa while South Korea and Japan follow di list in second and third place respectively.
Nigeria passport dey among di ten weakest passports in di world.
Nigeria rank 96th sharing di spot wit Ethiopia, Lebanon and Myanmar, dis four kontris get visa-free access to only 44 kontris.
Di weakest passports in the world dey Asia continent despite say di region get di strongest passports in di world on di index ranking list.
Four Asia kontris Pakistan, Yemen, Iraq and Syria top di list of di weakest passports in di world.
Seychelles na di highest ranked kontris for Africa wit access to 155 kontri globally.
Di kontri rank 26th position while Mauritius wey rank 29 on di list na di second Africa kontri wey top di list wit access to 148 kontris and South Africa rank 53 wit visa-free access to 102 kontris.
Afta dat, Botswana, Namibia, Lesotho, eSwatini, Morocco, Malawi, Kenya, Tanzania, The Gambia and Ghana follow in di list.
Top 10 countries wit di strongest passports in di worldDi top 10 kontris globally na:
.Singapore for di first place wit visa- free to 193 kontris.
.South Korea hold di second place wit visa-free to 190 kontris.
.Japan hold di third place wit visa-free to 189 kontris.
.Germany, Italy, Luxembourg, Spain and Switzerland hold di fourth place wit visa-free to 188 kontris.
.Austria, Belgium Denmark, Finland, France, Ireland and Netherlands hold di fifth place wit visa-free to 187 kontris.
.Greece, Hungary New Zealand, Norway, Portugal and Sweden hold di sixth place wit visa-free to 186 kontris.
.Australia, Czechia, Malta and Poland hold di seventh place wit visa-free to 185 kontris.
.Croatia, Estonia, Slovakia, Slovenia, United Arab Emirates and United Kingdom hold di eight place wit visa-free to 184 kontris.
.Canada hold di ninth place wit visa-free to 183 kontris.
.Latvia and Liechtenstein hold di tenth place wit visa-free to 182 kontris.











