BBC Pidgin of Monday, 12 May 2025
Source: BBC
Prime Minister Keir Starmer don outline plans to tighten immigration system wia govment plan to cut migration numbers significantly.
Di proposed changes include English tests for all visa applicants and dia adult dependants, as well as a longer route to get settled status.
Di PM also wan cut recruitment of overseas care workers, di measures aim to reduce legal migration, wey make up di majority of migration to di UK.
E no include addressing small boat crossings, or oda ways pipo dey arrive UK without permission.
Net migration (di number of pipo wey dey enta di country, minus di number leaving) hit 728,000 in di year to June 2024.
Di UK say dia plan to cut migration na to break from di past and ensure say anybody wey go settle for di kontri go be priviledge wey dem earn and not a right.
UK Home Office go release a White Paper wey go announce di new rules to tighten up work and study visas for di UK.
Meanwhile, Home Secretary Yvette Cooper tell di BBC say dis na time to end di recruitment of care workers from abroad.
Cooper add say dis new measures go cut up to 50,000 lower-skilled workers wey dey come from abroad next year.
Di goment plan to unveil series of changes to visa and recruitment laws on Monday, 12 May as part of efforts to cut dis net migration.
UK Prime Minister say di change wey dey inside di White Paper na "finally take back control of our borders".
White Paper na official govment document wey dey present di final, finished version of a govment proposal.
Dem dey use am share di plans wit di public and to provide guidance on how a policy go work.
Under one new goment plan to crackdown wey Home Office dey plan, pipo from kontris like Nigeria, Pakistan and Sri Lanka fit to find am more difficult to work and Study for UK.