You are here: HomeAfricaBBC2023 06 30Article 1795406

BBC Pidgin of Friday, 30 June 2023

Source: BBC

UK goment lose case to carry asylum seekers go Rwanda

Protesters against the asylum move dey celebrate di ruling Protesters against the asylum move dey celebrate di ruling

United Kingdom plan to send asylum seekers for di kontri go Rwanda dey unlawful, one Court of Appeal don rule.

Two judges – di Master of di Rolls and Lord Justice Underhill – don decide say di policy dey against di law.

Dem rule say di removal of asylum seekers go Rwanda dey unlawful until dem make changes to di asylum system for dia.

Dis judgement don reverse di decision one High Court ruling for December 2022 wey tok say dia removal dey lawful.

Dis one mean say UK goment don lose di latest round for di legal battle over dia controversial Rwanda deportation policy.

However, goment still fit challenge dis Appeal court ruling for di Supreme court

Wetin be di Rwanda Asylum Plan

Di five-year trial wey di UK goment announce for April 2022 – go see say dem send some asylum seekers go Rwanda wit one-way ticket plane to claim asylum for dia.

Dem fit grant these asylum seekers refugee status to stay for Rwanda. If not, dem fit apply to settle dia on oda grounds, or seek asylum for anoda "safe third kontri".

Goment say dis go stop pipo to dey enta UK through "illegal, dangerous or unnecessary methods", like to dey use small boats wey dey cross di English Channel enta di kontri.

More dan 45,700 pipo bin use dis route land UK for 2022, di highest figure since dem begin record am.

Small-boat crossings bin reduce small for di first few months for 2023 but di numbers fit rise again for di summer.

How di mata take waka

  • April 2022: UK goment bin announce di plan to send some asylum seekers go Rwanda, to stop pipo wey dey cross enta di kontri wit small boats from France


  • June 2022: Dem cancel di first flight wey dey carry asylum seekers from UK to Rwanda few minutes before take-off afta one intervention from di European Court of Human Rights (a non-EU body)


  • December 2022: Di High Court rule say di scheme dey lawful - but e tok say di cases of eight asylum seekers wey dey on board di June flight no dey “properly considered”


  • January 2023: Migrants wey dey face potential removal to Rwanda win permission to challenge di policy for di Court of Appeal


  • April 2023: Appeal hearing take place


  • Wetin di Court of Appeal ruling tok?

    Campaigners and asylum seekers don win one Court of Appeal challenge against di UK goment planned Rwanda deportation scheme

    Di Court of Appeal reverse one High Court ruling for December wey tok say dem fit consider di east African nation a "safe third country"

    Lord Chief Justice Lord Burnett announce di decision during one short hearing for London

    Di decision of most of di judges na say sake of di "deficiencies" for di Rwandan asylum system, substantial grounds dey to believe say real risk dey, say pipo dem send go Rwanda go go back di home kontris dem bin dey run from.

    Until dem correct those things wey dey lacking, removal of asylum seekers go Rwanda dey unlawful, di court rule.

    Di pipo wey appeal di case, charity Asylum Aid and ten asylum seekers, argue say substantial grounds dey to believe say real risk dey say dem go remove pipo wey dem send go Rwanda go back dia home kontri.

    How many pipo di UK wan send go Rwanda?

    UK bin tok say dem fit send "anyone wey enta UK illegally" afta 1 January 2022, dem no put limit on numbers.

    Rwanda during di trial tok say dem fit process 1,000 asylum seekers but dem get capacity for more.

    Under di deal, Rwanda fit also ask UK to take in some of dia most vulnerable refugees.

    But for October 2022, Privilege Style – di airline wey dem schedule to take asylum seekers go Rwanda - withdraw from dia Home Office contract, afta one campaign by refugee charities.

    Dat time, Guardian bin report say oda airlines wey don carry out deportation flights before, Titan Airways and AirTanker, also back out from di Rwanda scheme.