BBC Pidgin of Friday, 1 August 2025

Source: BBC

Trump sama Nigeria, Ghana and odas fresh tariffs - full list of kontris

US President Donald Trump US President Donald Trump

President of di United States don announce fresh tariffs for more than 90 kontris as im continue to dey drive reset how global trade don dey happun.

Di list of revised tariffs don show say di tariffs dey in line wit di US president Trump im policy to reset trade, sabi pesin Deborah Elms tok di BBC.

Trump bin first announce im tariff plan for April wey bin cause chaos around di world economy.

Im later postpone am so kontris including di UK fit negotiate deals.

Dis tariffs mean say companies wey bin dey bring foreign goods into di US go pay taxes to di govment wey experts don tok say dis companies go fit pass di costs onto dia consumers.

Wetin be di new Trump tariff percentage for kontris

Dis na di summary of tariffs on top goods from more than 90 kontris as di executive white paper for di White House website bin tok

African counties and di fresh tariffs

15% - Nigeria, Ghana, Angola, Botswana, Cameroon, Chad, Cote D'ivoire, DR Congo, Equatorial Guinea, Lesotho, Madagascar, Malawi, Mauritius, Mozambique, Namibia, Uganda, Zambia and Zimbabwe

25% - Tunisia

30% - Algeria, South Africa, Libya

Inside di executive order, some kontris gat exceptions

China still bin dey negotiate

Na so Canada dey face 35% tariff wey already don take effect.

Canada Prime Minister Mark Carney tok say im govment "dey disappointed" by President Trump im decision to raise di tariff on top Canadian goods outside Di US-Mexico-Canada trade agreement to 35%.

Inside one statement, Carney tok say govment go "focus on building Canada strong" in response to di new tariff.

"Canadians go be our best customer," Carney bin tok.

"We fit give ourselves more than any foreign govment go ever take away from us."

Mexico bin dey face 25% fentanyl tariff, 25% car tariff and 50% tariff on steel, aluminium and copper - all go take effect in 90 days.

Goods from di European Union dey face between 0-15% tariff wey go take effect from 7 August.

Brazil don get 10% tariff inside di executive order but dis na separate from di 40% den announce; dis dey mean say Brazil dey face 50% tariff on top most of dia goods.

Oda countries around di world and dia new tariffs

10% - Falkland Islands, United Kingdom and all oda kontris wey dem no list on top di executive order

15% - Afghanistan, Bolivia, Costa Rica, Ecuador, Fiji, Guyana, Iceland, Israel, Japan, Jordan, Liechtenstein, Nauru, New Zealand, North Macedonia, Norway, Papua New Guinea, South Korea, Trinidad & Tobago, Turkey, Vanuatu, Venezuela

18% - Nicaragua

19% - Cambodia, Indonesia, Malaysia, Pakistan, Philippines

20% - Bangladesh, Sri Lanka, Thailand, Taiwan, Vietnam

25% - Brunei, India, Kazakhstan, Moldova

30% - Bosnia & Herzegovina

35% - Iraq, Serbia

39% - Switzerland

40% - Laos, Myanmar (Burma)

41% - Syria

How we take reach dis point?

For 2 April, Trump bin announce wetin dem call 10% "baseline" tariff on top all imports.

Di president tok say goods from about 69 oda trade partners wia di White House don describe as di "worst offenders" (including di EU and China), go face higher rates as payback for dia unfair trade policies.

Dem later postpone dis tariffs for 90 days to allow time to negotiate individual trade deals, wia dem extend di deadline.

Days bifor di 1 August deadline, di US and EU bin agree say European goods go face 15% tariff - including cars.

Under dis deal, wia all 27 EU members gat to approve, di trading bloc go charge companies 0% duty on top certain products.

US-Chinese negotiations don dey continue afta di two bin increase tariffs on top goods to more than 100% bifor dem reduce am temporarily.




Di fresh tariffs for more than 90 kontris be part of Trump im drive to reset how global trade don dey happun