BBC Pidgin of Thursday, 11 December 2025

Source: BBC

Trump launch $1m 'gold card' immigration visa to give wealthy foreigners direct path to citizenship

US President Donald Trump US President Donald Trump

President Donald Trump don launch one scheme wey dey offer fast-tracked US visas to wealthy foreigners wey fit pay at least $1m, dat na about ₦1,453,890,000.00 (one billion four hundred fifty-three million eight hundred ninety thousand naira)

Di card go give buyers "direct path to Citizenship for all qualified and pipo wey di US don check. SO EXCITING! Our Great American Companies fit finally keep dia invaluable Talent," Trump tok on social media on Wednesday, 10 December.

Di Trump Gold Card, wey e first announce earlier dis year, na one US visa dem go award to pipo wey show say dem go provide "ogbonge benefit" to di kontri, according to di scheme official website.

Dis dey come as Washington continue to ginger dia immigration crackdown, wey include raising work visa fees and deporting undocumented migrants.

Tins to know about di gold card visa

Di Gold Card scheme promise US residency in "record time" and go require $1m fee wey be "evidence say di pesin go really benefit from di United States", di programme website tok.

Businesses wey dey sponsor employees go pay $2m, plus additional fees.

Di "platinum" version of di card wey dey offer special tax breaks go also dey available soon for $5m, di website tok

Authorities fit charge extra fees to di govment depending on each applicant circumstances, di site add

Individuals go also pay one non-refundable $15,000 processing fee bifor dem review dia application.

Di gold card scheme don face criticism since e first announce am for February, as some Democrats tok say e go unfairly favour wealthy individuals.

Wen Trump first reveal di plan, e bin tok say di visas dey similar to green cards, wey dey allow immigrants of various income levels to live and work permanently for di US.

Green card holders normally dey become qualified for citizenship afta five years.

But di Gold Card target na for "high-level" professionals, Trump tok, e emphasise say, "we want pipo wey dey productive".

"Di pipo wey fit pay $5m, dem go create jobs," Trump tok. "E go sell like crazy. Na bargain."

Di scheme dey come as Trump administration don put plenty resources to deporting immigrants.

America also don pause immigration applications by individuals from 19 countries, mostly for Africa and for di Middle East, wey dey in line wit di president travel ban.

Di govment don also pause all decisions on asylum applications and say dem go review thousands of cases wey bin dey approved under di administration of President Joe Biden.

For September, Trump bin also sign one order to charge a $100,000 fee for applicants of di H-1B visa programme for skilled foreign workers.

Di decision cause panic among overseas student for di US and technology firms. Di White House later clear am say di fee go apply only to new applicants wey currently dey abroad.