BBC Pidgin of Tuesday, 16 December 2025
Source: BBC
US President Donald Trump don file $5bn (£3.7bn) lawsuit against BBC for one edit of im 6 January 2021 speech for one Panaroma documentary.
Trump don accuse di broadcaster of defamation and say dem go against trade practices law, dis na according to court documents wey dem file for Florida.
Di BBC bin tell Trump sorry last month, but dem reject im demands for compensation and no gree say "reason dey for defamation claim".
Trump legal team bin accuse di BBC say dem defame am by "intentionally, maliciously and deceptibely doctoring im speech". Di BBC neva ansa di lawsuit.
Last month, Trump say e dey plan to sue di BBC for di documentary, wey bin show for di UK bifor di US election.
Trump bin tell tori pipo say, "I think I go need do am. Dem bin cheat. Dem change di words wey comot from my mouth".
For im speech for 6 January 2021, bifor riot bin start for di US Capitol, Trump bin tell crowd say, "we go walk down for di Capitol and we go cheer for our brave senators and congressmen and women."
More dan 50 minutes into di speech, e tok say, "and we fight. We fight like hell".
For di Panorama programme, one video clip show am dey tok say, "we go waka go di Capitol... and I go dey dia wit you. And we fight, we fight like hell".
Di BBC gree say di edit bin give "di mistaken impression" wey fit show say e bin "make direct call for violent action", but dem no gree say e dey cause defamation claim.
For November, one leaked internal BBC memo bin call out how dem edit di speech. Di mata na im make BBC director general Tim Davie and di head of news, Deborah Turness to resign.
Bifor Trump file di lawsuit, lawyers for di BBC don give one long ansa to wetin di president claim.
Dem tok say malice no dey for di edit and di programme no affect Trump as dem re-elect am soon afta di programme show on air.
Dem also say di BBC no get right and no share di Panaroma programme for dia US chammels. And even though di documentary bin dey BBC iPlayer, na only for UK viewers.
Trump lawsuit point out di agreements di BBC get wit oda distributors to show content, mostly di one wit one third pary media corporation wey allegedly get licensing rights to di documentary outside di UK. Di BBC neva tok anytin about dis claims, but di corporation wey di alleged distribution agreement neva say pim.
Di suit also claim say pipo for Florida fit don watch di programme if dem use VPN or if dem use di streaming service wey dem dey call BritBox.
Di lawsuit tok say, "di Panorama Documentary publicity plus di increase use of VPN for Florida since e start, establish di big likelihood say Florida citizens access di Documentary bifor di BBC bin remove am".