You are here: HomeAfricaBBC2023 09 28Article 1852793

BBC Pidgin of Thursday, 28 September 2023

Source: BBC

Tribunal declare Kaduna govnorship election inconclusive

Justice Victor Oviawe Justice Victor Oviawe

Di election petition tribunal wey siddon for Kaduna don declare di state govnorship elections wey happun early dis year inconclusive.

Di tribunal on Thursday, declare di March 18 govnorship election wey happun for di state dey inconclusive.

Di three-man panel wey dey led by Justice Victor Oviawe, order rerun for 24 polling units inside seven wards of four local goment areas of Kaduna and dis consist of 16,300 registered voters.

Na di Peoples Democratic Party (PDP) candidate Isa Ashiru bin dey challenge govnor Uba Sani victory for di tribunal.

Di judges deliver di judgement via zoom just as dem bin do for di Kano state judgement last week.