You are here: HomeAfricaBBC2023 03 09Article 1727870

BBC Pidgin of Thursday, 9 March 2023

Source: BBC

Train accident in Lagos: At least two pesin die, several injure as train crush goment bus for Lagos

Di scene of di accident Di scene of di accident

Dem don confirm at least two pipo dead and several pipo injure as one moving train jam one Lagos State goment bus for PWD bus stop for di Ikeja area of Lagos on Thursday morning.

Di Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) tok-tok pesin, Adebayo Taofiq confirm di sad incident to tori pipo.

Rescue operation dey currently go on as first responders arrive di scene of di accident.

Tok-tok pesin for di National Emergency Management Agency for Lagos, Ibrahim Farinlo also confirm di incident to tori pipo.

"Two adult females staff of di State Government wey die and several wey dey injured don dey evacuated."

"Di State goment staff bin dey try cross di PWD/Sogunle rail crossing while di train wey dey come into Lagos from Abeokuta trap di bus ontop rail," e add.

Two NRC flag Officers bin reportedly try to stop di driver of di bus from crossing but dem say di driver ignored di directive and drive into di rail.

Many fotos from di accident too dey gory and we no fit share dem.

Dis na some of di fotos wey we fit share:

Dis na developing tori, dey refresh to see more update