BBC Pidgin of Monday, 28 July 2025

Source: BBC

'To Kill A Monkey come at di right time for my life' - Stella Damasus

Ogbonge Nollywood actress Stella Damasus say acting for di ogbonge movie 'To Kill A Monkey' come at di right time for her life.

Damasus tok wen she siddon wit BBC News Pidgin to tok about di latest Kemi Adetiba film wey dey totori pipo and wey she act inside as Nosa - one of di main characters.

"Evri choice wey you make get consequence. No mata di reason wey you take make am. If you put hand for dirty, dirty go follow you." Damasus tok as she share di lesson wey di movie dey try pass across.

She say di big lesson from di film na to show how human beings take be and na evribodi get flaw, get problem and na wetin di storyline dey try show be dat.

On how some pipo receive di movie sotay dem dey try relate Nosa role to who Damasus be for real life, Damasus say: "Na beg I dey beg, na feem. Becos I don see pipo say Nosa make you no enta mainland o. Anoda one say if una see wia dem dey flog Nosa, make una call me I must join."

Howeva, to her, wetin pipo dey tok get anoda meaning as she see am as opportunity to prove say di pipo like di acting for di movie, and di cast do ogbonge work.

"I like di fact say dem no fit tell di difference becos dat mean say we do veri good work, wey be say dem believe say na me be dat, but make dem also remember say na story we dey tell.

"All di emotions, all di cry, all di triggers evritin, I don face am bifor I enta set. Becos if I enta set, I no fit let dose tins affect me. I go dey react to di characters but wen I don do dat part finish, I need to now come transition."

Also, di opportunity to act di role according to Damasus, bin come at di time wey she tok say she bin wan come back Naija from America to do more tins.

'Marriage dey end' - Stella Damasus

Di movie dey also come at a time wey Stella Damasus dey news sake of her marriage wey end. Damasus say she don move on.

"Di role come at di right time wey I wan dey come naija now dey work. Afta evritin end for corner, I don alreadi move on, I get work wey I dey do."

Di actress say she no dey allow wetin pipo dey tok to affect her and she no dey listen to dem becos she dey focus on hersef.

"I don dey di game to understand say, no mata wetin hapun, pipo go get dia own opinion. If you notice, I no dey ansa anybody, I no dey fight anybody.

"I dey tell pipo say my life, I dey too interesting. I neva understand mysef finish for di tins wey I get to do. I no get di time to begin tok."

According to Damasus, marriage dey end and no be today.

"Pipo dey marry, marriage dey end. Nobodi follow me dey inside bedroom or parlour.

I no get di energy to begin address tins,. My own na say if you wan tok beta, come my front."

Wen BBC News Pidgin ask Stella Damasus if she go marry again, she say she no dey look for.

"Dat one na God hand e dey o. As I dey so, I dey okay. I no dey actively look for, I don born pikin. I no want, but na God na im go decide.