You are here: HomeAfricaBBC2023 06 13Article 1785017

BBC Pidgin of Tuesday, 13 June 2023

Source: BBC

Tins you need sabi about student loan bill president Tinubu sign

President Bola Ahmed Tinubu President Bola Ahmed Tinubu

President Bola Tinubu don sign into law di Student Loan Bill.

Dis na part of di promises wey di president make during im campaign.

This was announced on Monday by the spokesperson to the Federal Government Mister

Dele Alake, tok-tok pesin to di president confam di signing to tori pipo for State House, Abuja on Monday.

Oga Alake say di money go dey under Ministry of Education and and na only students wey dey higher institution wey poor go fit access di money.

Tins you need to sabi about dis new act

Na former Speaker of the 9th House of Representatives, Femi Gbajabiamila, propose di bill wey di Lawmakers just pass two weeks ago.

Dis new Act go establish di Nigerian Education Bank wey go get di power to supervise, coordinate, administer and monitor di management of student loan for Nigeria.

Students also fit to apply for dis student loan through higher institutions for di kontri on dia behalf.

Applicants go go through screening to determine weda dem meet all di requirements for di loan.

Di Act full name na “An Act to Provide Easy Access to Higher Education for Nigerians Through Interest Free Loans from Nigerian Education Bank Established in dis Act wit View to Provide Education for All Nigerians and for Related Matters.

Dis new act na very powerful act wey according to law wey create am, must stand kakaraka, “notwithstanding anytin to di contrary wey dey for anyoda Act or for any oda enactment or law.”

Irrespective of wetin any oda law tok, you fit to apply dis law to any tin wey concern di application and granting of student loan to Nigerians wey wan school for Nigeria.

Di Student Loan Act no get hand for any mata wey concern to go school abroad o.

Na arrangement wey di Nigerian goment do form im kontri pipo wey wan beta demsef inside Nigeria.