BBC Pidgin of Tuesday, 22 April 2025

Source: BBC

Tins wey happun wen President Bola Tinubu go abroad

FCT Minister Nyesom Wike bow down dey shake President Bola Tinubu hand FCT Minister Nyesom Wike bow down dey shake President Bola Tinubu hand

Nigeria President Bola Tinubu don return to Abuja from Europe afta im working visit to Paris and London.

Oga Tinubu land Abuja on Monday night and some ogbonge goment officials welcome am for di Nnamdi Azikiwe International airport.

According to di Presidency, di reason wey President Bola travel on dis working visit na to score di midterm performance of im administration and to also assess key milestones.

"Im go also use di retreat to review di progress of ongoing reforms and engage in strategic planning ahead of im administration second anniversary.

Meanwhile, as dem dey celebrate di increase for di foreign exchange reserve for di Central Bank of Nigeria, and as Bola Tinubu travel on a" short working visit" different kasala bin dey happun for di kontri wey make ogbonge politicians begin call am to come back house.

Politicians hala make Tinubu 'comeback'

One of di politicians wey first drag President Bola Tinubu na Peter Obi - di 2023 Presidential election candidate for Labour Party.

Im tell President Tinubu to comeback from im travel to con face di insecurity challenges for di kontri.

"I dey moved at dis time in our lives as a nation to call our retreating President attention to di security challenges at home, wey need am to immediately suspend im ongoing retreat for a foreign land and come home to address di overwhelming security situation across di kontri.

"Dis urgent call don become necessary sake of di rising incidents of crimes and criminalities all ova Nigeria wey no be like say governance dey.

Di Presidential candidate of di main opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar also para as President Tinubu comot sake of insecurity.

"Di Tinubu administration don prove, time and again, to dey utterly incapable, and wholly incompetent, and completely devoid of any coherent ideas for tackling Nigeria's deepening security crisis. Dis no be just my position — na di growing consensus among political opposition leaders, respected security experts, and even members witin di ruling party..."

"Yet President Bola Tinubu,wey no dey capable to solve Nigeria worsening insecurity, choose instead to gallivant across Europe — governing Nigeria in absentia as if na from a holiday perch. If im no fit act, di leaset im fit do na to show up."

How goment respond to di calls

Di Preidency for Nigeria no keep quiet at all ass di calls for Tinubu return bin dey increase.

For statement wey di Special Adviser to the President, Information and Strategy Bayo Onanuga sign, im tok say "President Bola Tinubu dey fully engaged in Nigeria governance even though im dey Europe.

Im absence dey temporary and in line wit di communicated timeframe of approximately two weeks.

Di President comot from Paris for London for weekend and im dey maintain constant communication wit key goment officials, overseeing critical national matas, including directives to security chiefs to address emerging threats for some parts of di kontri.

Even though dem state earlier say na two weeks oga Mr President go spend, e later spend 18 days.

Some tins wey happun wey President Tinubu travel

For inside di ova two weeks wey President Bola Tinubu bin no dey around some kasala happun for some states.

Plateau State: Insecurity challenge hit Plateau state as about 50 pipo die for Bassa local goment area, north-central Nigeria, according to wetin residents tell BBC Pidgin.

Dis fresh attack happun for di early hours of Monday April 14, between 1am and 2am.

Jaguda pipo kill dozens of villagers for inside anoda attack for Plateau State

Few weeks ago, anoda 52 pipo bin kpai for inside anoda attack for Bokkos local goment area of di same Plateau State.

Di development make di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu to visit di area and tok say enough don dey enough for di killers, and e go make sure say di killings stop.

Benue State: Di Death toll for Benue herdsmen attack on Logo and Gbagir rise to 56

Dis kasala dey happun for Ukum local goment for Benue State, north central Nigeria, afta one coordinated attack by suspected herdsmen.

Di Nigeria Police Force, Benue Command, say di attack happun on Thursday night around 9pm.

Borno State: Many pipo no dey fit sleep again, some don run comot sake of

How some residents dey live in fear under Boko Haram and Iswap control for Borno State

Last weekend, Senator Ali Ndume tell tori pipo for Abuja say three local goment areas currently dey under Boko Haram control.

Di local goments na Gudumbari, Marte and Abadam.

E neva tey wey Borno State Govnor Babagana Zulum complain say Boko Haram and Iswap attacks don increase again for di state. E tok say federal goment gatz take action bifor di mata worse pass as e be now.

Protests and counter protests for Rivers State: Di oil rich Niger Delta state na one of di places wey pipo eye dey becos Tinubu declare state of emergency for Rivers State and suspend Govnor Fubara

E no end dia o, di appointment of di Sole Administrator wey don dey do plenti tins for di state.

Di appointment of Local goment administrators plus oda tins wey don happun for Rivers since President Tinubu declare state of emergency dey make pipo para.

Recently, protests from different groups happun for di state as Oga Tinubu bin travel.

Some say make federal goment bring back suspended govnor Siminalayi Fubara while anoda group say dem like di Sole Administrator, Vice Admiral, Ibok -Ete-Ibas.