You are here: HomeAfricaBBC2023 11 23Article 1886258

BBC Pidgin of Thursday, 23 November 2023

Source: BBC

Thanksgiving for US, wetin e be?

President Biden for 2023 Thanksgiving President Biden for 2023 Thanksgiving

Thanksgiving na holiday wey Americans dey celebrate every year on di fourth Thursday for November.

Dis year thanksgiving go take place on Thursday 23 November.

For many families, na chance to gada togeda aside di family time dem also dey do Thanksgiving parades to mark di occasion.

Di Macy Thanksgiving Day Parade, na one of di biggest and most famous, di parade dey happun for New York.

Many pipo dey use Thanksgiving as a day to reflect on positive things for life.

Nearly evri body dey get one or two days off school or work, dis period dey mark di beginning of Christmas holiday season.

Wetin be di history of Thanksgiving?

Thanksgiving Day go as far back to wen Europeans bin go start dia new lives for America.

For 1621, one group of Europeans, wey dey known as di 'Pilgrims', invite di local Native Americans to join dem for a feast.

Di Pilgrims bin dey struggle to grow enof food to eat di years before.

Di Native Americans bin teach dem how to grow crops successfully and, according to di story, to thank dem for wetin dem do, di Pilgrims invite dem for a big feast.

Unfortunately di good relations between Native Americans and pilgrims no last long, violence between European settlers and Native Americans increase and lead to many years of fight-fight.

How pipo dey celebrate?

During di occasion most pipo dey cook plenty food for all dia family, dem dey eat big Turkey – dis don become tradition becos dem believe say di Pilgrims probably bin eat tolotolo alias turkey around di time of di first Thanksgiving feast.

Why tolotolo? Tori be say dem bin dey haunt wild tolotolo wen Thanksgiving first start, and e become more popular as di Thanksgiving food of choice afta American President Abraham Lincoln declare Thanksgiving as a national holiday for 1863.

But if tolotolo no be your tin, foods boku to eat on dat day.

Foods like potatoes, gravy, vegetables and sweet pies dey menu.

Dem dey pardon tolotolo

Every year American president dey stop one tolotolo to become Thanksgiving dinner.

Since 1947, na di National Turkey Federation dey give di President one turkey for evri thanksgiving.

To pardon tolotolo don become tradition since 1989.

Di tolotolo wey dem free go den live di rest of im days for a petting zoo.

Oda activities wey dey happun on dat day na American Football

American football games dey shele on Thanksgiving Day evri year, na tradition wey di National Football League don keep.

Some pipo dey like odas tins for during thanksgiving, dem dey do tins wey include spending di day to volunteering to serve thanksgiving dinner to di homeless.

Many pipo dey attend religious services, dem dey prayer during dinner time and tell odas wetin dem dey thankful for.