BBC Pidgin of Wednesday, 27 August 2025
Source: BBC
American Pop superstar Taylor Swift don announce her engagement to her partner Travis Kelce.
For one post on Instagram on Tuesday, Swift write say: "Your English teacher and your gym teacher dey marry."
She follow di post wit fotos wey show as di Kansas City Chiefs star Kelce dey propose to Swift.
Di fotos show as di two of dem hug each oda and hold each oda hands, and e show her diamond engagement ring.
Within one hour she post am, Swift post don already get more dan six million likes.
Ms Swift, wey recently finish her record-breaking Eras Tour, na one of di biggest music stars on di planet wit plenty of awards to her name.
Most of her songwriting and back catalogue bin dey about her previous relationships, as fans dey fight ova di lyrics to try guess who her songs dey about.
In recent years, pipo don see she and Kelce togeda for plenty events and di NFL star don also appear for her concerts.
Di announcement of dia engagement dey just days afta di singer give one rare insight into her relationship wit Kelce during one highly anticipated appearance on im podcast.
Na love tori... How Taylor and Travis meet
During di interview on New Heights, wey Travis brother co-host wit Jason Kelce, Within one hour she post am, Swift post don already get more dan six million likes.
Ms Swift, wey recently finish her record-breaking Eras Tour, na one of di biggest music stars on di planet wit plenty of awards to her name.
Most of her songwriting and back catalogue bin dey about her previous relationships, as fans dey fight ova di lyrics to try guess who her songs dey about.
In recent years, pipo don see she and Kelce togeda for plenty events and di NFL star don also appear for her concerts.
Di announcement of dia engagement dey just days afta di singer give one rare insight into her relationship wit Kelce during one highly anticipated appearance on im podcast.
Swift bin tok how she and Travis become couple and she tok about dia life together.
Close to di beginning of di show, dem ask Swift why she chose to appear on di podcast, wey di koko na primarily to sports fans.
"Dis podcast na im make me get boyfriend," she tok, as she accuse Travis say e use di broadcast as im "personal dating app" to connect wit her.
Bifor dem even meet, Kelce dey always tok on di podcast about how e attend one of Swift concerts and how e dey disappointed say dem no meet.
E bin tok about making beaded friendship bracelet, wey dey popular during di Eras Tour, and say im bin wan give her im phone number.
She say di clip, wey go viral, bin dey like "e dey stand outside of my apartment, and e hold one boom box wey dey shout, 'I wan go on a date wit you'".
Family and friends come begin tell her to take him up on im offer.
"My relatives, my cousins, be like, 'Please, please, please, na beta pesin e be. E get friends wey be like, really na correct guy e be, e be great pesin'. Plenty pipo dey tell me things for my ear about you."
She say na exactly di moment she bin "dey write songs about, wanting to happen to me since I be teenager".
"E dey wild, but e work... E be di good kind of crazy," she tok, as she call her boyfriend "a human exclamation point".
Since dem come togeda, pipo dey regularly wee di two of dem togeda, dem see as Kelce dey often support Swift during her record breaking Eras tour.

