A planned nationwide protest against bad governance don kick off across various states for Nigeria.
According to di organisers of di nationwide protest, Take It Back Movement na to call attention to demand an end to crackdown on free speech and ongoing bad governance fpr di kontri.
Di organisers say make pipo gada for different locations wia dem don identify across di kontri so dem go fit press home dia demands.
Dem add say di govment dey use di Cybercrime Act to silence citizens and dem want make dem stop di Act.
Di demonstration dey take place for several cities wey include Abuja, Oyo State, Jos, Borno, Akure, Ore, Lagos, Maiduguri, Rivers, Port Harcourt and odas.
Di theme of di nationwide protest na "Nationwide protest against bad governance and free speech suppression", according to di organisers.
"Leaders wey dey fear criticism no dey fit to lead, expression no be crime. Journalists, activists and ordinary pipo dey silence under di Cybercrime Act. Di na fight for our digital freedom," di group tok for dia X page.
According to di group, dem say dem write letter give di police to protect dem during di protest becos na dia democratic right.
Di organisers say Nigerian goment dey use di Cybercrime Act of 2024 oppress Nigerians, and e call for serious concern.
According to di National Coordinator of di Take It Back Movement, Comrade Sanyaolu Juwon wit oda leaders of di group across various states of di kontri, dem say di Cybercrime Act dey target journalists, human rights activists and oda helpless Nigerians.
"Na weapon of mass suppression wey dey designed to silence Nigerians w dey dare to challenge di corrupt and illegitimate powers wey dey including opposition voices, journalists, and young pipo wey dey freely express dia opinions for TikTok and Twitter."
Dem call for di "immediate and unconditional repeal of di Cybercrime Act to safeguard di rights enshrined for di Nigerian Constitution".
"Accordingly, we go call out Nigerians for a series of protest actions, mass demonstrations until dis oppressive Act dey thrown to di dustbin of history."
"We go kontinu to fight for a Nigeria wia freedom of expression no be a privilege, but a fundamental right."
Wetin police tok?
Di Nigeria Police Force say dem dey worry about di planned protest.
According to di statement from di tok tok pesin for di Police Muyiwa Adejobi, e say April 7 na day wey di goment don declare as National Police Day to celebrate di dedication of officers Nigeria Police Force.
But di Force dey concerned say dat same day na wen di organisers bin choose to protest across di kontri.
"Di Nigeria Police Force hereby advise di organizers not to carry out dis planned protest as e no be di appropriate time and e dey mischievous," Police tok.
Adejobi tok say di Inspector-General of Police, IGP Kayode Egbetokun get respect for rights of citizens, make di protesters follow di proper govment institution tok on wetin be dia demand.
"Di Inspector-General of Police hereby urge all di organizers of di planned protest as well as individuals wey intend to join di protest to pursue dialogue to press home dia demands."












