BBC Pidgin of Thursday, 10 July 2025

Source: BBC

Supreme Court set to deliver judgement on Edo State govnorship election

Di Supreme Court confam Monday Okpebholo as di validly elected govnor of Edo State Di Supreme Court confam Monday Okpebholo as di validly elected govnor of Edo State

Di Supreme Court confam Monday Okpebholo as di validly elected govnor of Edo State

Di mata na between Asue Ighodalo wey be candidate of Di Peoples Democratic Party (PDP) and Monday Okpebholo, candidate of di All Progressives Congress (APC), wey di Independent National Electoral Commission, Inec bin declare as winner of di election.

Ighodalo bin come second for di election but e claim say Inec bin no comply wit di electoral rules and say dem deliberately favour di APC candidate.

Di PDP candidate also allege say plenty cases of over voting bin hapun during di election and if dem remove dose votes, na im suppose be di winner of di election, no be Okpebholo.

But Oga Asue Ighodalo bin lose di case for both di Edo State Governorship Election Petition Tribunal and di Court of Appeal, as di two courts confam Okpebholo as di winner of di election.

Di two lower courts agree say PDP and dia candidate no provide enough evidence for court to prove say wuruwuru bin dey for di election, or say Inec bin no follow di electoral guideline.

Dis na why Ighodalo carry di mata go Supreme Court wey be di highest court, asking dem to set aside di decisions of di tribunal and di Appeal Court, and to declare am winner of di govnorship election.