Di Black Queens of Ghana go begin dia 2025 Women Africa cup of nations (Wafcon) on Monday at 4:00pm GMT wit defending champions Bayana Bayana from South Africa.
Di group C match go happun for di Honor stadium for Morocco.
Sabi pipo believe say di Bayana Bayana na favourites for dis game; as dem be only one of three kontris to win di competition aside Nigeria (9) and Equatorial Guinea (2).
Di South Africa team dey fine form wit 7 wins from 7 games for 2025, wey Ghana get only 2 wins from 7 games (4D, 1D).
Ghana wey neva win di championship, dey di same group C wit Mali and Tanzania.
Dem lose for 3 finals (1998, 2002 and 2006) all against Nigeria, wia dem also no feature for di last tournament, di first time in four competitions.
Wetin di coaches tok ahead of di game
Ghana new head coach Kim Lars Bjorkegren believe say di black Queens need to believe for dia vision for di competition and try to win di game."We sabi say we be underdog for dis game, but we need di quality inside dis team to beat anybody for here," oga Kim tok for pre-match press conference.
Im gree say dem no prepare ahead of di tournament well sake of limited training sessions and only friendly matches.
Some pipo bin wonder if age of di squad go affect dia performance for di tournament, coach Kim no tink so.
"We no go win or lose sake of age; di best players go dey di park wia we dey hope say di best team go win."
Bayana Bayana coach Desiree Ellis dey confident say all her players dey focused to defend dia title.
Sabi pipo fear say di players no go dey di correct frame of mind for dis game afta dem bin protest for Morocco ova non payment of dia bonus from previous camps.
But dia coach Ellis tok say dem bin solve all dia issues.
"Di mood for camp na good one, we dey focused for di job against Ghana."
Ellis tok say "even though Ghana miss di last tournament for 2022, dem bin come back strong dis year wit dia new coach; we get to beat dem and win our first game."
Head-to-head
South Africa and Ghana bin face each oda last for dis Wafcon for 2016 wia di black queens win am 1-0 to finish third.
For dia last 5 games, South Africa don win 4 times wia Ghana win only once (di 2016 3rd place game).
For 8 officials games dis year, Ghana bin win only 3 (1-0 v Senegal, 3-1 v Malawi and 4-2 v Benin).
South Africa bin win all dia 7 games dis year.
Bayana Bayana dey rank 54th for di world and 2nd for Africa; Black queens dey 66th for di world and 6th for Africa.
Ghana go dey hope dia key players - Princess Marfo, Portia Boakye, Doris Boaduwaa and Evelyn Badu go carry di team get di three points from Bayana Bayana.
But dem get to also challenge star players Refiloe Jane, Linda Motlhalo and Jermaine Seoposenwe.

Di black queens bin miss di 2022 tournament na so dem go try to make statement dis year but na tough tin against di defending champions Banyana Banyana

Aside Super Falcons of Nigeria wey win di competition 9 times, Equatorial Guinea also bin win 2 wia South Africa bin win one











