You are here: HomeAfricaBBC2024 01 01Article 1906364

BBC Pidgin of Monday, 1 January 2024

Source: BBC

Slangs wey trend for social media and street for 2023

Different slangs form part of evriday conversation among Nigerian pipo Different slangs form part of evriday conversation among Nigerian pipo

Evri year pipo dey drop different slangs wey dey form part of evriday conversation among Nigerian pipo.

E get some slangs wey trend for street and social media for 2023, dis words dey show street credibility and smartness but no be evribodi like to dey adopt street slangs but e dey sometimes influence how we take dey yarn wit oda pipo.

Nigerians dey like to yarn and catch cruise ontop social media wit dis slangs and e dey help dem lighten dia mood and cope wit di economic hardship for di kontri.

You fit don forget di slangs wey dem use wella for street and social media for 2023 or make you no just dey familiar wit dis slangs.

Well, dis article go tell you wia some of dis slangs originate and how dem dey use am for street and social media.

No evidence

Dis one originate from one viral video of popular Nigeria artiste Burna Boy. For di video, e tok say, "You go explain tire becos no evidence".

E mean say even wen you dey tok truth pipo no go still believe you becos you no get prove say di incident happun.

Idan Gangan (Di real Idan)

Idan na Yoruba word wey mean "magic" in Yoruba language. Idan Gangan means di real Idan.

For 2008 Abass Akande Obesere and Rasqie release di song Idan (Magic).

But ontop internet e mean say you get magic finger and you dey powerful. You fit do wetin odas no fit dare do witout any consequence.

Let di poor breathe, no suffocate dem

Na President Bola Tinubu use dis phrase "let di poor breathe, no suffocate dem, we get dat responsibility" wen im dey tour di presidential villa for Abuja for May.

But pipo dey use di slang to express say somtin dey impressive or you fit use am to express frustration about situation wey dey tough.

Groceries, floating berries, sweetener and brighten serum.

Groceries na anoda name for garri. Pipo dey call am groceries wen dem no wan make dem know say na garri, groundnut, sugar and milk dem wan chop. Groundnut (floating berries), sugar (sweetener) and milk (brighten serum).

Dey play my fans

Although, “Dey play” bin trend last year, but dis year influencers don add "my fans". So “Dey play my fans” don begin dey trend for 2023. Di slang dey tell pipo say make dem dey serious and no dey waste time on wetin dem dey do.

On Colos

Well, Colos mean hard drug but dem dey use am to ask if pesin dey tink wit im right senses. Dem fit just ask di pesin weda im dey on colos?

Adam go stain your white

Dis na anoda word for breakfast but mostly for females, becos na about women wey dey suffer heartbreak (chop breakfast) from dia partner.

In dis context, Adam mean 'man'.

Sora fun Obirin 'Dey careful wit females'

Dis na Yoruba words wey mean say make pesin dey careful wit females. Dem dey use am to warn oda men wen one pesin don chop breakfast (heartbreak) from im woman.

No gree for anybodi

Di slang start inside one viral video, wen one man bin dey fight dog wey im landlord release for cage make im bite im fellow tenant. Pipo dey use di slang to challenge dia superior or pesin wey wan intimidate dem.