You are here: HomeAfricaBBC2023 12 07Article 1894577

BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023

Source: BBC

Seychelles declare state of emergency afta huge explosion

File foto File foto

Seychelles President Wavel Ramkalawan don declare state of emergency for di kontri, afta one very heavy explosion happun for one industrial zone on di main island, Mahé plus flooding.

Di Seychelles leader don order all citizens except essential workers to siddon for house.

Plenty pipo injure sake of di explosion.

Di blast happun for one construction and quarrying company, wia dem dey store explosives, di explosion cause serious havoc for di industrial zone of Providence.

Di international airport also dey affected, even though e dey 4km (2.5 miles) away.

Schools dey closed and di only movement wey dey allowed na into and out of thedi holiday islands.

We still dey update dis tori