You are here: HomeAfricaBBC2023 02 23Article 1720091

BBC Pidgin of Thursday, 23 February 2023

Source: BBC

Security operatives arrest factional Biafran separatist leader Simon Ekpa for Finland

Simon Ekpa (third left) dey arrested for Finland where im base Simon Ekpa (third left) dey arrested for Finland where im base

Finland authorities don gbab popular pro-Biafra separatist agitator, Simon Ekpa wey order sit-at-home for di southeast region ahead of di Nigeria presidential election on Saturday 25 February.

Di Finnish press agency Helsingin Sanomat tell BBC Igbo say dem reporter bin go Ekpa house on Thursday for interview wey e bin don already gree to do with am, wen dem see security officers for Ekpa house trying to remove am.

Di news outlet reporter Matilta Jokinen further tell BBC Igbo say di police no anwser her when she ask why dem arrest Ekpa.

Ekpa for several tweets on different days bin order sit-at-home on election day across di southeast and dey also threaten wahala if anyone dare comot to go vote.

Im arrest dey come days after di Nigeria goment bin summon di Finnish Ambassador to Nigeria Leena Pylvanainen sake of Ekpa threat to stop di 2023 general elections for southeast.

Di Nigeria Foreign Affairs Minister say Nigeria goment no go take am “lightly” wit Ekpa and di Finland goment if dem no do anytin about di agitator threats.

Who be Simon Ekpa?

Simon Ekpa na Nigerian-Finnish Biafran agitator wey be self-acclaimed disciple of detained leader of di Indigenous People of Biafra, Nnamdi Kanu.

Ekpa wey dey live for Finland dey champion di restoration of Biafra Republic and calling on Igbo pipo wey dey for southeast to boycott di general elections unless di Federal Goment release Kanu.

Ekpa for im Twitter page describe imsef as human rights activist, CEO, senior legal advisor at Ekpa & Co Oy, legal researcher, author, analyst, Finnish politician and Biafra tok-tok pesin.

E currently get ova 66,000 followers on Twitter and na one of di social media wey im dey use give pronouncements to im followers.

Di agitator bin recently declare five days sit-at-home order starting from 23 February to 28 and dis one dey make pipo of di southeast fear say di presidential election fit no hold for di region.