BBC Pidgin of Monday, 18 August 2025

Source: BBC

Search operation kontinu for missing passengers for Sokoto boat accident

Some pipo for boat dey look for pipo bin miss for boat accident Some pipo for boat dey look for pipo bin miss for boat accident

Different families dey mourn as dem dey count dia loss afta tragic boat accident happun on Sunday for Sokoto state, Northern Nigeria.

Na normal day for di pipo wey dey Gojiyau town for Goronyo local govment area wen di news break.

Tori be say di victims dey on dia way to di weekly Goronyo market wen dia boat, wey carry both passengers and goods, capsize for afternoon.

Local media say na over 40 pipo, mostly traders dey inside di boat. Di National Emergency Management Agency (NEMA), Sokoto Operations Office (SOO) say di number pass 50.

Usman Dangaliman of Ruwan Goronyo confirm to BBC News Pidgin say boat accident happun for one village wey dem dey call Kojiyo.

Contrary to di tori dem, Dangaliman tok say na about 25 pipo wit dia okada try cross river so dem go fit reach market wey dey Goronyo town.

"25 pipo get boat accident wen dem dey try go one market wey dey Goronyo town."

As e be now, e say dem still dey do rescue work for pipo wey di mata touch.

"We don recover di dead bodi of one person so far for di water, wit six okada wey dey inside di boat wen di accident happun", Galadima talk.

E tok say up till now dem neva fit identify di pipo wey di accident catch.

"Na only one dead bodi we don see, but we still dey find 24 pipo wey dey inside di boat. We no fit identify di oda victims wey dey inside di boat."

For dia effort to rescue pipo wey di mata affect, Galadima tok say dem don announce for oda close villages near dem make dem help find pipo wey miss.

"As e dey now, we don gather fishermen wey dey do rescue work to find di remaining 24 pipo wey miss.

"We don also make announcement for oda villages wey dey near us make dem help us find di remaining missing pipo," Galadima tok.

While on di oda di National Emergency Management Agency (NEMA), Sokoto Operations Office (SOO), don send dia response team go support rescue work wey dey go on afta one serious boat accident wey happun for Sokoto State, northern Nigeria.

Di agency tok dis one for one statement dem release for dia social media page on Sunday.

Di Director General of NEMA, Madam Zubaida Umar, quick activate di Agency response as she hear say one boat wey carry go Goronyo Market don capsize.

"NEMA SOO, in collaboration wit local authorities and emergency responders, dey intensify search and rescue operations to locate di missing persons," NEMA tok.

NEMA add say dem dey work wit local authorities and emergency pipo to make search and rescue so dem fit find di people wey still dey miss.

For Nigeria, boat accident dey happun plenty for remote areas, especially during rainy season, and e dey always carry pipo life and property go.

But expert wey chook mouth put for di mata believe say overload dey among plenty tins wey dey cos boat mishap for Nigeria.