You are here: HomeAfricaBBC2023 11 16Article 1882427

BBC Pidgin of Thursday, 16 November 2023

Source: BBC

Saudi Arabia, Air Peace mata – Wetin don happun so far

Air Peace plane | File foto Air Peace plane | File foto

Tori don plenty about how Saudi Arabia bin cancel 177 Nigerians visa mid-flight as dem dey travel on Sunday.

Di kasala burst afta di 264 passenger Air Peace flight bin land for Jeddah.

Tori be say na ony 87 pipo dem give clear road to enta while do odas bin collect about turn back to wia dem come from.

Di tori bin loud on top say nobody bin know wetin cause di mass deportation of pipo wey don collect visa and everytin to waka go.

Affected passengers bin tell local tori pipo say e shock dem wen dem hear say dem don cancel dia visa wen dey land.

Dis na as dem say dem bin don meet all di requirements to take enta di Middle East kontri.

But on Wednesday, di Saudi Arabia embassy for Nigeria reveal say di pipo wey dem do back to sender for bin no fulfil entry conditions.

For statement dem say, di passengers "bin submit wrong information to get di kain visa wey no apply to dem, wey dem find out on dia arrival."