Dame Sarah Mullally don become di new Archbishop of Canterbury designate - di first woman wey dem go choose for di role.
One former NHS chief nurse, di 63-year-old become priest for 2006 and dem appoint am as di first female Bishop of London for 2018 - di third most senior member of clergy for di Church of England.
Na di first time in nearly 500 years of history wey di Church bin nominate a woman to lead am.
Di Church don dey witout someone for di top job for almost one year afta Justin Welby resign sake of safeguarding scandal.
E bin step down afta bad report into one prolific child abuser wey dey associated wit di Church. Di report find out say e "fit and suppose" report John Smyth abuse of boys and young men to police for 2013.
Archbishop of York Stephen Cottrell bin take on most of Mr Welby responsibilities temporarily, and na one of di voting members of di body wey dem charge wit choosing pesin wey go replace am. Im sef don face calls to step down over im handling of one abuse case.
Women bin first dey ordained as priests for di Church for 1994, while di first female bishop appointments happun 20 years later for 2014
In line wit tradition, di process of choosing new archbishop involve name wey dem go give to Prime Minister Sir Keir Starmer and den pass to di monarch.
Sir Keir don welcome Dame Sarah appointment, and say: "Di Archbishop of Canterbury go play key role for our national life. I wish her evri success and look forward to work togeda."
While, technically, di King na di head of di Church of England, di pesin wey hold di role of Archbishop of Canterbury na di most senior bishop and na di spiritual leader of di Church and di worldwide Anglican Communion.
She bin dey married wit two children, and she spend ova 35 years for di NHS and become di youngest eva chief nursing officer for England for 1999.
Although she bin dey volunteer for di Church at di time, na just few years later she decide to become priest and dem quickly give am responsibility to help make reforms in di way di institution dey deal wit abuse.
For 2012, she become canon treasurer for Salisbury Cathedral bifor she become Bishop of Crediton for di diocese of Exeter for 2015.
As Bishop of London, dem see am as pesin wey bin use her experience as NHS administrator to help modernise di diocese.
She tok about di appointment dat time: "Pipo dey always ask me wetin e be like to don get two careers, first for di NHS and now for di Church.
"I prefer to tink say I don always get one vocation: to follow Jesus Christ, to know am and to make am known, always seeking to live wit compassion for di service of odas, weda as nurse, a priest, or a bishop."
Perhaps di most urgent tin for her na still to chart beta path towards dealing wit abuse and treating wit more compassion dose wey dey affected by am.
Di Church attendance don also reduce, though London don to some extent do somtin about dat trend.
One of di areas wia she don dey tok about well-well na assisted dying - she be big opponent, just like di Archbishop bifor her.
Wen legislation bin dey passed in di Commons, she describe am as "unworkable and unsafe and pose a risk to di most vulnerable pipo for our society".
One of her roles as Bishop of London na to chair a body wey dey try steer di Church decision on weda to bless same-sex marriages.
She describe di decision to finally allow priests to bless same-sex couples for 2023 as "a moment of hope for di Church".
Rowan Williams, wey be former archbishop, summarise her new role as requiring a "newspaper for one hand and a Bible for di oda".
Dr Williams tell di BBC say "di expectation to get opinion on evritin dey quite heavy."











