You are here: HomeAfricaBBC2023 02 07Article 1710044

BBC Pidgin of Tuesday, 7 February 2023

Source: BBC

Reports say dem find Christian Atsu under Turkey earthquake rubble

Christian Atsu Christian Atsu

Latest reports from Turkey dis morning be say dem don pull Christian Atsu from de wreckage of di earthquake alive.

Turkish journalist, Yagiz Sabouncouglu reveal dis on en Twitter handle.

Dis confirmation dey come from de Turkish sports journalist despite say e initially debunk claims say dem rescue Atsu.


According to Yagiz, dem carry Atsu go hospital for treatment sake of e get injuries.

Inside tweet wey e share e write, “Hatayspor Manager Mustafa Özat: I just had anoda meeting. Dem carry Christian Atsu go hospital with injuries.”


Sporting world bin call for prayers tori break say Atsu bin trap.

Ghana president Nana Akufo-Addo join many Ghanaians all over de world to pray for di safety of Christian Atsu.

President Akufo-Addo for statement wey e release also commiserate wit di govents of Turjey and Syria for de disaster.

“On behalf of di govment and people of Ghana, I extend heartfelt condolences to de govments and peoples of Turkey and Syria on de devastation and de tragic loss of lives Monday’s earthquake cause. May their souls rest in perfect peace.

“Our hearts and prayers go out to de survivors, and we pray dat say make dem see our fellow Ghanaian, Christian Atsu.

Di Ghana Football Association also tell fans to "pray" for former Chelsea and Newcastle forward Christian Atsu – wey tori tok say dey trapped under rubble for di earthquakes in Turkey.