President Bola Tinubu receive report on Ogoni wia e order immediate engagement wit di Nigerian National Petroleum Company Limited (NNPCL) and di pipo to finalise di modalities to resume oil production for dat region.
Oga Tinubu issue di directive during di presentation of di report by di Presidential Committee on di Ogoni Consultations wey Professor Don Baridam chair.
During di presentation, President Tinubu confer posthumous national honour of Commander of di Order of di Niger (CON) on four members of Ogoni wey die wen dem dey struggle to ensure environmental protection of dia land.
Howeva, di announcement of oil resumption for Ogoniland don raise kwesion as to why be say na di next tin wey di president dey order be dat.
Earlier, President Tinubu bin grant presidential pardon and confer national honours on di Ogoni Nine, wey bin lead to di death of late environmental activist and writer Ken Saro-Wiwa.
Dis na men wey lead to oppose di operation of Shell oil corporation for di Niger Delta region in di 80s.
For June 2025, family of late Ogoni environmental rights activist Ken Saro Wiwa say review of di trial wey result to di execution of dia papa go heal all dia wounds and ensure say further miscarriage of justice no go kontinu wit pipo wey dey protest dia fundamental rights.
Di pipo of Ogoni don react to di President announcement say make oil exploration kontinu for dat region, but wetin dis mean for di pipo and wat next?
'We dey against resumption of oil operation'
Popular Ogoni activist Celestine Akpobari tell BBC News Pidgin say to dey honour pipo wey don die sake of say dem wan resume oil for dat area wey cause dia death no good.
Celestine wey be from Rivers State region say di President suppose restore di environment back to good position so dem go fit return to dia business.
"Our problem na di complete destruction of our environment, di poverty wey don set in, destruction of our livelihood. Wetin di president go do na to restore our environment so our pipo fit go back to fishing and farming."
As activist wey dey follow di Ogoni activities, Celestine say some communities for di Niger Delta no get light for di past 21 years.
"We dey against resumption of oil operation for dia, no be only Ogoni, di entire Niger Delta. I go Oloibiri and wetin I see worry me. For di past 21 years, electricity no dey.
"Dem mess up di whole place for Niger Delta and dem run away. See how much dollars oil well dey make from Niger Delta, but how many belong to Niger Delta pipo."
Activist tok wetin President Tinubu suppose do next
"E dey strange say some group of pipo go just generate report and send am to di presidency. Di last time we do our findings, townhall meetings bin hold and dem no properly capture di views of di Ogoni pipo for dat report."
Dis na wetin Kentebe Ebiaridor wey be program manager for Environmental Rights Action and coordinator of Oilwatch International bin tok.
Kenteba say di report wey dem go submit give President Tinubu go dey public and dem no fit access di report.
E add say President Tinubu suppose make di pipo heal first bifor dem resume any oil exploration for Ogoni.
"E gatz dey clear say Ogoni no want resumption of oil for dat land sake of say dem don go through years of destruction to dia environment and dem neva heal from dat assault by multinational oil companies."
According to Kentebe, di President gatz provide safe environment for di pipo of Ogoni bifor any oil activity resume again, and no be to give pardon to di pipo wey die for di struggle.
"As di president dey go in line to resume oil production for dat region, di first na to provide safe environment for dem to feel accepted back into environment wey originally polluted."
Kentebe say e dey important to exonerate dose wey dem murder like Ken Saro Wiwa and odas, no be to give dem pardon becos dem no commit any crime.
"Why dem wan resume oil production for dat place wen di land dey polluted. Dem only stand for dia environment and dia rights. Pardon no dey enough to heal di wounds of di pipo."
Di activist say President Tinubu gatz ensure say di pipo of Ogoni bin feel connected to dia land back.











