BBC Pidgin of Monday, 22 December 2025

Source: BBC

Remaining Niger State school children, and staff wey kidnappers gbab don dey released - Officials

Di remaining students and teachers wey bandits bin kidnap from St Mary's Catholic School, Papiri, for Niger State, don regain dia freedom and dem go reunite wit dia family dis Monday morning.

Chairman of di Christian Association of Nigeria for Niger State and di Catholic Bishop of Kotangora Diocese, Bulus Dauwa Yohanna, confam di development to BBC.

Bishop Yohanna wey also be di proprietor of di school tok say "Di govnor just call me now to inform me say di remaining schoolchildren and teachers don dey released. E tell me to come and receive dem."

Also, tok-tok pesin of President Bola Tinubu, Sunday Dare, announce for im official X handle say none of di students and staff now remain for captivity.

Di Niger State Commissioner of Police Adamu Abdullahi Elleman also tell BBC say di released students and teachers dey undergo some examination by security forces and dem go take dem to dia school dis Monday to hand dem ova to dia family.

Remember say jaguda pipo bin break into St Mary's Catholic School dormitory for Papiri, Niger State on November 2, for di middle of di night and pack plenty of di students and teachers - about 303 in total - enta bush.

Di school management say 50 of di schoolchildren bin escape during di attack but more dan 200 remain for captivity.

On December 8, authorities tok say dem don secure di release of 99 schoolchildren and one teacher, wey mean say at least 165 odas bin still remain for di den of di kidnappers.

However, di Niger state police oga tell BBC say di 130 pipo wey dem release late on Sunday don account for di total of di remaining abductees, as e tok say di initial figures wey di school management bin release no dey accurate.

Di police bin don accuse di school management say dem no dey cooperate wit dem wit di rescue, and dat na afta Bishop Yohanna bin tell BBC say govment no dey make any meaningful effort to rescue di children and dia teachers.

As e be now, even though govment no tok weda dem pay any ransom, di release of dis students and dia teachers go bring big relief to families, even as pressure dey mount on govment to prevent future attacks.

Wen di bandits bin release di first batch of 100 pipo for December 8, di govnor of neighbouring Nasarawa state, Abdullahi Sule, bin tell local media say di federal govment bin play a key role, but e add say di behind-di-scenes efforts no fit dey disclosed for security reasons.

Dis na one of di largest mass kidnappings of students for Nigeria for recent years and e don also show di fragile security situation across plenty areas for di kontri.

Afta di mass abductions for Niger and neighbouring Kebbi state in November, Nigeria govment bin shut all di 47 unity schools across di country pending wen dem go fit guarantee di security and safety of schoolchildren.

On December 18, govment announce di reopening of di schools as dem tok say dem don strengthen security architecture witin and around di schools premises.

But schools for Niger state generally still neva open bicos di state govment insist say dem go only open wen dem fit guarantee security in and around schools.

On 9 December President Bola Ahmed Tinubu promise say im govment go continue to work wit Niger and oda states "to secure our schools and make di learning environment safer and more conducive for our younger ones".