Nigeria President Bola Tinubu don suspend di state of emergency wey e ealrier announce for Rivers State sake of di crisis wey bin dey happun for di state dat time
Dat time, President Tinubu suspend Govnor Siminalayi Fubara and im deputy, Prof. Ngozi Odu for six month- inclduing di House of Assembly members.
E make dat declaration for im nationwide broadcast on Tuesday 18 March 2025, wia e say e dey invoke Section 305 (5) of di 1999 Constitution to make di declaration.
Howeva, for Monday 17 September 2025, Tinubu say im dey happy to hear say all di stakeholders for Rivers State don show passion to return to democratic govnance.
" I diafor no see why di state of emergency gatz exist day longer dan di six months I bin pronounce for di beginning.
"E give me great pleasure to declare say di emergency for Rivers State go end wit effect from midnight today."
Tinubu say gov Fubara, di deputy govnor, Ngozi Nma Odu, and members of di Rivers State House of Assembly and di speaker, Martins Amaewhule, go resume work for dia offices from 18 September 2025.
Wetin Tinubu tok as e lift di state of emergency
President Tinubu say bifor e declare state of emergency for Rivers State, breakdown of law and order bin dey.
Oga presido say e dey sad say Rivers State govnor bin demolish di House of Assembly complex for ova 18 months and neva rebuild am back wia e add say no good and responsible president go standby and allow di situation to continue witout taking steps wey dey inside di Constitution to address di situation.
E say wen im put mouth for di kasala wey dey happun for Rivers State, both di govnor camp and di speaker no gree as dem stick to dia positions instead make dem choose peace for di state.
"E become painful say to stop di kasala for Rivers State, I gatz invoke di powers conferred on me by Section 305 of di 1999 Constitution, to proclaim di state of emergency."
Oga Tinubu say im dey aware of ova 40 cases wey dey court for Abuja, Port Harcourt and Yenagoa wey dey challenge im declaration of di state of emergency for Rivers State.
"Dat na how e suppose be for democratic setting. Some cases still dey pend for courts till today.
"E for be colossal failure on my part as President make I no make dat proclamation. Di pipo wey vote us into power expect to reap di fruits of democracy," e tok.
President now say im dey happy to receive intelligence say Rivers State don get di spirit of "understanding, readiness, and excitement on di part of all di stakeholders for Rivers State for immediate return to democratic govnance".
E say no need to extend di state of emergency for di state again and make all oda govnors choose peace for dia states.
"I take dis opportunity to remind di govnors and di Houses of Assembly of all di states of our kontri to continue to appreciate say na only atmosphere of peace, order, and good govnment fit deliver di dividends of democracy to our pipo."
Who bin dey in charge of Rivers State for six months?
President Bola Tinubu bin swear in Vice Admiral Ibok-Ete Ibas (Rtd) as di Sole Administrator of Rivers State at di State House, Abuja, di kontri capital.
President Tinubu say di administrator no fit make any new laws but e fit form regulations wey di Federal Executive Council gatz approve for di state.
President Tinubu swear in di sole administrator to take charge of Rivers for six months.
Ibok-Ete Ekwe Ibas na retired Nigerian Navy Vice Admiral, wey be di 22nd Chief of Naval Staff (CNS) of di Nigerian Navy from 2015 to 2021.
Rivers sole administrator say e don achieve im mandate afta six months
Rivers State sole administrator, Vice Admiral (Rtd) Ibok-Ete Ekwe Ibas, say e don achieve di mandate wey President Tinubu bin give am.
E make dis declaration for Govment House, Port Harcourt, wen di Rivers State Independent Electoral Commission (RSIEC) present di comprehensive report of di recently concluded local govment elections to di state administrator.
Vice Admiral Ibas say di peaceful conduct of di polls and subsequent swearing-in of democratically elected chairmen and councillors across all 23 local govment areas mark di direct fulfilment of di presidential directive to am on March 18, 2025.
"Mr. President mandate to me dey clear: to stabilise di state, create enabling environment for di re-establishment of di institutions, and return Rivers State back to full democratic govnance," di administrator tok.
"Wit di successful conduct and swearing-in of local govment chairmen and dia councils, I believe say we don decisively achieve di mandate wey dem give us."
Wetin be state of emergency?
State of emergency na temporary measure wey govment fit declare during crisis wey dey threaten di public safety, order, or govnance.
E dey grant authorities special powers to respond to di situation effectively.
Dis powers fit include suspending certain rights, deploying security forces, restricting movement, and overriding normal legislative procedures.











