Police don begin investigate di fire incident wey lead to di death of 29 year old Sunny Amadi for Choba, Rivers State
Pipo shock wen tori burst say Sunny Amadi die from severe burn wey e suffer from di fire im supposed girlfriend allegedly cause.
BBC Pidgin gada from a relative of di girlfriend say di incident hapun for Ogbogoro road for Choba, near di University of Port Harcourt campus for di girlfriend off-camp apartment, and e leave her in a condition wey dey very severe as she sef suffer serious burn injuries.
"According to wetin she tell us, on di day di tin happen, she bin comot go buy somtin. Wen she return she see say candle dey on for her house.
"She surprise becos though light bin no dey, she no light any candle for her house. Wen she reach she she her former boyfriend inside di house wit a gallon of fuel."
Di relative explain say she and di boyfriend bin don break up and she don tell am make e no call her or come near her again, but e dey beg her but she no gree.
"E say dem come begin argue as she tell am to comot from her house and in di process di fuel come pour and catch fire from di candle na so di fire burst cover di two of dem.
"So she try run comot from di house but already di fire don also burn her bodi.
"Na one neighbour call me say make I come see wetin don hapun, na so I rush come from village amd we carry dem go hospital.
"Unfortunately di boyfriend don die from di injuries wey e get but she sef dey critical condition too as she suffer second degree burns wey cover her bodi."
Police begin investigation to know wetin cause di fire
Police tok tok pesin, SP Grace Iringe-Koko confam say her boyfriend die for hospital while she dey receive medical treatment.
Police tok say dem neva know di cause of di fire but pipo dey alledge say na di girl wey be 300-level female undergraduate student of di University of Port Harcourt set her boyfriend on fire.
Dem tok say dem dey torchlight di mata and dey pray for di lady so she go dey strong enough to tok wetin really hapun between dem as her condition also dey very critical from di burns she suffer and she also dey pregnant for di boyfriend wey don die.
"Di police don locate di pregnant girl, wey dey receive medical treatment for hospital due to injuries she wey she sustain during di incident. She dey heavily pregnant wit di deceased pikin. Due to her critical condition, she no fit provide detailed account of di incident, but she go do so wen her condition dey stable," di police tok-tok pesin tok.
"We neva ascertain di cause of di fire, and we don launch thorough investigation to know di circumstances wey dey surround di incident."











