Just 12 minutes afta di first earthquake hit Myanmar, another one strike, according to US Geological Survey.
Di second one get a magnitude of 6.4, e record, less than di earlier one of 7.7.
Di epicentre dey 18km (11.1 miles) south of Sagaing.
Forty-three construction workers dey miss afta powerful earthquake cause one unfinished 30-storey building for Bangkok to collapse, Thai authorities tok.
Fifty pipo bin dey inside di building near Chatuchak Park, wey dey hundreds of miles away from di earthquake epicentre for Myanmar.
Seven bin escape while 43 odas still dey trapped, di National Institute for Emergency Medicine tok for Facebook post.
AFP news agency also bin report di 43 pipo wey dey miss, dem quote police.
"When I arrived to inspect di site, I hear pipo dey call for help, dem say help me," Worapat Sukthai, deputy police chief of Bang Sue district, tell AFP.
Di building dem plan am for goment offices.
'I panic well-well', Bangkok resident tok
Bui Thu, one BBC journalist wey dey live for Bangkok, tell BBC World Service Newsday programme say she bin dey her house dey cook wen di first quake happun.
"I bin dey very nervous, I panic well-well," she tok. "I bin no know know wetin e be becos e don reach, I think a decade since Bangkok experience really strong or powerful earthquake like dis."
"From my apartment I just see some cracking for di walls and water splashed out of swimming pools and pipo just dey just shout."
Sake of aftershock, she, along wit oda pipo, run out enta street.
"We just dey try to wrap our heads around wetin dey going on," she tok.
"Buildings for Bangkok no dey designed for earthquakes, so I feel say na why I think di damage go big."
Wetin we know so far
Di earthquake
.One powerful 7.7 magnitude earthquake hit central Myanmar, according to US Geological Survey
Di epicentre na 16km (10 miles) north-west of di city of Sagaing, wit depth of 10km, di USGS say
.Thailand and south-west China bin feel strong tremors hundreds of miles away
Di damage
Buildings dey damaged for Bangkok, and roads scata for Myanmar capital, Naypyidaw
Buildings for Bangkok usually no dey designed to withstand earthquakes, so di damage fit serious well-well
Goment response
Thai goment dey holding emergency meeting.
Why updates from Myanmar dey difficult to get
Na military junta dey rule Myanmar since di coup wey happun for 2021, sake of dis, access to information dey difficult. Di state dey controls almost all of local radio, television, print and online media.
Internet use also dey restricted.
Also e be like say Communication lines dey down as BBC no fit get through to aid agencies wey dey ground.
How common earthquakes be for Myanmar?
Earthquakes dey more common for Myanmar, compared to Thailand.
Between 1930 and 1956, na about six strong quakes of 7.0 magnitude near di Sagaing Fault don happun, wey run dey through di centre of di kontri , AFP news agency reports, dem cite USGS.
Thailand no be earthquake zone and nearly all earthquakes wey dem don feel dia, wey dey rare, na from neighbouring Myanmar.
As buildings for Bangkok no dey engineered for powerful earthquakes, di structural damage fit dey significant.
'I feel di earthquake for a long time,' Yangon resident tok
Soe Lwin, for Yangon, Myanmar largest city, say im bin feel di earthquake for a "long time".
But, im say e no dey like say widespread damage dey for di downtown area of di former capital.
Im add say residents dey worried about di potential for another, bigger earthquake in di coming days.
State of emergency declared in six regions of Myanmar
Di military junta wey dey rule Myanmar since one coup for 2021 don declare a state of emergency for di regions of Sagaing, Mandalay, Magway, Bago, Easter Shan state and Naypyidaw, according to local media reports.
For one statement wey we don see dem add say officials go investigate di damages and begin coordinating rescues for affected areas.
Roads crack and building scata for Myanmar
Checkout some images now from Naypyidaw, di capital of Myanmar.













