BBC Pidgin of Wednesday, 2 April 2025

Source: BBC

Popular Christian preacher chop life imprisonment for raping woman

Bajinder Singh get millions of followers on social media Bajinder Singh get millions of followers on social media

Indian court don sentence a self-styled Christian preacher Bajinder Singh to life imprisonment for raping one woman for 2018.

Di woman accuse Singh of raping her for im home in di northern state of Punjab.

She add say e record di act and use di video later to blackmail her.

Singh wey get millions of followers rise to fame for im evangelist-style of preaching and events.

For some of di events, dem dey see wia e dey do "healing" for pipo wey dey suffer from serious illnesses by placing hand ontop dem.

Di Church of Glory and Wisdom wey be one of di largest private churches for Punjab, also dey count some Bollywood stars as followers.

Di church say e get branches across di world.

According to im website, di branches dey for kontris such as di US, UK and Canada.

Singh also get better presence on social media wit more dan three million subscribers for YouTube.

Di preacher dey attend sessions wey plenti pipo dey present, in sharp suits.

E dey known for giving fiery sermons wia e dey often claim say e fit make pipo extremely wealthy and cure dem of illnesses.

For many of im viral videos, e show wia e dey totori di crowds.

E dey place im hands on di followers wey shake and bring out tins from dia mouth bifor e go claim say e don miraculously heal dem from wateva dey make dem sick.

On Tuesday, afta di court pronounce di punishment for Singh for di 2018 rape case, di lawyer wey represent di woman, Anil Sagar, clap hand for di decision.

Di lawyer say na "exemplary punishment".

"Any leniency for such case wia pipo use dia social position to rape poor and weak pipo dey increase di confidence of predators," Mr Sagar tok.

Singh lawyers neva comment on di court judgement. E dey expected to appeal against di order for di high court.

More accusation for di preacher

Di preacher also dey accused of sexual assault by at least two oda women. For February, police begin investigation afta a former disciple accuse am of sexual assault.

Days later, di Punjab police register a third case against Singh for allegedly assaulting anoda woman afta a prayer session.

E don deny di two allegations.

Im churches don also face financial scrutiny. For January last year, some of dem dey under investigation by India income-tax department.

Dem born di preacher Singh for Haryana state for a Hindu family.

E bin reportedly convert to Christianity about 15 years ago wen e dey for prison. Media reports tok say e dey jail in connection wit a murder case, but e neva publicly commented on am.

For im website, e claim say "evil forces" don push am towards a life of crime bifor pesin give am a Bible and e find God.

Im website also refer to am as a "prophet" and e dey offer "services" of healing pipo wit holy oil and water.

Sake of di various criminal cases against am, dem describe am as a controversial figure for di media.

But im supporters defend am- and Singh imself don previously push some of di negative press to "schemes" and "plots" by rival pastors wey no like am.