Police don arrest Andrew Mountbatten-Windsor on suspicion of misconduct in public office according to reports.
Police say King Charles brother dey dia custody and officers dey search houses for Berkshire and Norfolk
Photos show as cars arrive for di Sandringham Estate for Norfolk earlier dis morning.
Dis na after Thames Valley Police bin tok say dem dey assess complain over di alleged sharing of confidential material by di former prince with late sex offender Jeffrey Epstein.
Dem say dem don open investigation.
Andrew, wey turn 66 today, don consistently deny any wrongdoing elating to di Epstein files,
Dal Babu, one former Chief Superintendent for di Metropolitan Police, tell BBC News say pressure bin don dey grow ova di last few weeks.
Di ex-senior police officer say as police don arrest Andrew now, dem go dey able "to access im computer equipment, files, photographs, plus any oda evidence".
E also say officers "fit carry out searches for any premises wey e own or live, or any oda premises e dey control, so searches fit still hapun for oda areas as well".
How di tori of Andrew arrest break
Na di UK media house, Mail Online, bin first publish foto of wetin look like police officers near di Sandringham Estate wia Andrew Mountbatten-Windsor dey stay, and BBC later confirm say police arrest somebody dia dis Thursday morning.
Thames Valley Police na dem bin dey chook eye into some allegations of misconduct for public office and na very significant moment for di former prince to dey arrested.
E don previously deny kpatakpata any wrongdoing on any of di accuse wey relate to Epstein.
Di Thames Valley police also later issue a statement wia dem confirm say dem don arrest one man from Norfolk wey dey im sixties "sake of suspicion of misconduct for public office", and say dem carry out searches for addresses in Berkshire and Norfolk.
"The man remain for police custody at dis time. We no go name di arrested man, sake of national guidance," di statement tok.
"E dey important say we go protect di integrity and objectivity of our investigation as we work wit our partners to investigate dis alleged offence.
"We understand the significant public interest for dis case, and we go dey provide updates at di appropriate time." Di statement add.
How long police fit hold Andrew?
BBC Radio 5 bin tok wit Danny Shaw wey be policing commentator about wetin dis arrest of Andrew Mountbatten-Windsor actually involve.
Shaw tok say di highest wey police fit hold di former prince na 96 hours (or four days) - but e go require multiple extensions from senior police officers plus order from Magistrate Court.
For most cases, di suspects fit dey custody reach 12 or 24 hours bifor dem go either dey charged to court or dem go release dem pending further investigation, Shaw tok.
Andrew fit enta cell "in a custody suite" wit just "one bed and one toilet", and na dia e go wait until im interview wit di police. Shaw tok say "no any special treatment go dey for am".
As tins be now, BBC neva know di exact time wen Andrew bin dey arrested or wia dem dey hold am.
'Di law must to take its course' - King Charles
Di King of England later release statement about im broda Andrew arrest and dis na wetin di statement tok:
"I don learn wit di deepest concern di news about Andrew Mountbatten-Windsor and suspicion of misconduct for public office.
"Wetin go follow now na di full, fair and proper process by which dis issue go dey investigated for di appropriate manner and by di appropriate authorities.
"For dis one, as I don tok bifor, dem get our full and wholehearted support and co-operation.
"Make I tok am clearly: di law must take its course.
"As dis process continue, e no go dey right for me to comment further on dis matter.
"Meanwhile, my family and I go continue for our duty and service to you all."
Royal business continue as usual but...
As pressure bin don dey mount over Andrew dis week, King Charles and oda senior royals don maintain dia "business as usual" approach.
Some senior royals dey scheduled to take part for engagements later dis Thursday.
Queen Camilla land for one engagement for Westminster, central London, despite her brother-in-law arrest wey dem announce dis morning
She attend one lunchtime orchestral concert, and representatives greet am as she land dia.
On Wednesday, di King and Queen bin dey for Barking and Dagenham wia dem bin meet wit organisations wey dey provide support to di local community.
Also on Wednesday, Radio 1 bin publish di appearance of di Prince William for one of dia panel discussion on mental health - although dat session bin dey recorded for di end of January.
Di day before, di Queen bin get some engagements for Bath.
Last week, di Prince of Wales bin also make official trip to Saudi Arabia, but di attention throughout dat trip bin dey very much on Andrew back at home.
E dey clear say di work of di wider Royal Family continue to dey overshadowed by questions about di King younger brother - and dis arrest today mean say tins go continue like dat for some time.











