You are here: HomeAfricaBBC2023 07 17Article 1806350

BBC Pidgin of Monday, 17 July 2023

Source: BBC

Police dey investigate death of 21-year-old student as boyfriend confess to murder on Instagram

File foto File foto

Police for Lagos, southwest Nigeria, say dem dey investigate di death of 21-year-old Onuwabuagbe Augusta Osedion wey her boyfriend Benjamin aka Killaboi confess say na im kill am.

Di dey come afta di young man wit ova 66k followers on Instagram bin confess on im story say im and im girlfriend bin get argument and im mistakenly stab am to death. For series of updates for im Instagram story, e also share screenshots of di message im send to di girl mama where e tok say im no intend to kill im girlfriend.

Di tok-tok pesin for di Lagos Police Command SP Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin say di mama of di deceased, Onwabhagbe Cordelia of Military Cantonment, Maryland area of Lagos, on Saturday 15 July bin report to di police say her pikin tell her say she bin quarrel wit her boyfriend on Tuesday 11 July.

According to Hundeyin, di Augusta mama say she bin make effort to reconcile di two lovers but she no dey able to reach dem on dia phones or oda platforms.

Cordelia bin tell di police say she de reach di daughter roommate and di lady lead dem to di boyfriend house for Oral Estate for Ikota, Ajah where dem recover her daughter Mercedes Benz C30 and dem no fit access di apartment.

SP Hundeyin say DPO of Ajah police station lead detectives to di scene and dem break di door and discover di lifeless body of Augusta. Police confirm say Augusta private part bin dey miss wen dem find her lifeless body.

Dem recover di deadi bodi wey don dey rotten.

SP Hundeyin add say dem see marks of violence and signs of struggle for di body of di victim and dem deposit am for di General Hospital Mortuary for Yaba for autopsy and preservation.

E say dem also recover one note wey Benjamin put for di scene and dem dey treat am as exhibit.

“Police don cordon off di scene as preliminary investigation dey go on so we go fit transfer case to SCID Panti for secret investigation,” SP Hundeyin tell BBC Pidgin.

Refresh di page for more details as dis na developing tori