You are here: HomeAfricaBBC2024 01 10Article 1910567

BBC Pidgin of Wednesday, 10 January 2024

Source: BBC

Police dey chook eye as Tiwa Savage file petition against Davido

Tiwa Savage and Davido Tiwa Savage and Davido

Di Nigerian Police force don confam say afrobeats singer Tiwa Savage don submit petition say her fellow singer Davido dey bully and threaten her life.

Dis na as both Davido and Tiwa Savage bin unfollow diasef ontop social media sake of di issue wey dey happun between dem.

All of dis wahala between di two popular Nigeria singer bin start according to Tiwa Savage, wen she bin post picture wey include her and one of Davido baby mama wey be Sophia Momodu.

Benjamin Hundeyin wey be di police tok-tok pesin for Lagos state confam give BBC Pidgin say di petition wey Tiwa Savage submit don reach dia hand and dem go begin chook mouth for di mata.

"As you don see di police stamp and di post wey Tiwa Savage make, I fit confam to you say dem don submit dat kain petition to us", Hundeyin tok.

According to Tiwa Savage, Davido begin dey tok disrespectful words to her ontop di picture wey she post for her own Instagram story.

Tiwa tok for her petition say Davido dey vex for wetin she no know but she need to remind am of how she bin stand gidigba wit di family wen Davido bin lose im son.

According to wetin Tiwa tok for her petition, Davido dey send messages to her manager say she dey taunt am and Davido come dey use malicious words to damage her pesin.

“For 23 December, I bin make a post wey include myself and Sophia Momodu for my Instagram story- wey be feature for Instagram wey go allow you to put up a post for twenty-four hours."

"Mr David Adeleke bin send messages to my manager wey also dey part of im management team say make I no worry and never say a word to am and dat say I dey taunt am, as e dey utter very đisrespectful, malicious and derogatory words to my pesin."

Tiwa add say pipo wey dey close to her and Davido don begin dey reach out to ask wetin I do to am say im dey vex say I still dey close to Sophia Momodu wey born one of im pikin, Imade.

According to di petition by Tiwa, Davido dey try make her look like di 'aggressor' and different calls and messages don dey disturb her since she bin post di picture wit Sophia for her Instagram story.

"Di events wey happun dat day don lead to plenti calls and messages from our mutual connections, wey dey ask me wetin I do to Mr David Adeleke wey make am dey upset and dat I bin chose to maintain a relationship wit Sophia Momodu, wey im dey get issues wit."