You are here: HomeAfricaBBC2023 07 17Article 1806431

BBC Pidgin of Monday, 17 July 2023

Source: BBC

Pipo faint, some hide under umbrella as hot weather dey 'bake' pipo for Europe

Heat conditions spike for Europe Heat conditions spike for Europe

Most part of southern Europe dey face serious heat, as Greece dey see temperatures wey reach 40C (104F) or more.

Authorities don close di Acropolis, di kontri most popular tourist attraction during di hottest hours of di day to protect visitors.

Di European Space Agency (ESA) say Italy, Spain, France, Germany and Poland fit see extreme conditions.

E fit reach 48C for parts of Italy, wey go make am become "di hottest temperatures wey dem go ever record for Europe", according to di European Space Agency.

Di hottest temperature wey dem don ever record for Europe na 48.8C for Sicily for August 2021.

Reports dey of plenty pipo, including tourists wey don collapse for di heat for Italy. At least one pesin don die.

Di kontri meteorological society don call di heatwave Cerberus afta di three-headed monster wey feature for Dante Inferno.

Di weather agency don also issue red alert warning for 10 cities, wey include Florence and Rome.