BBC Pidgin of Wednesday, 16 July 2025

Source: BBC

'Pipo dey call me DJ wey no get hand' - Deejay Bankyroy

Deejay Bankyroy lose im hands for electric shock accident in September 2023 Deejay Bankyroy lose im hands for electric shock accident in September 2023

Twenty-six year old, Bankole Ridwan Ishola wey pipo sabi as Deejay Bankyroy lost im lower arms two-years ago for one electrical accident wey happun for wia e dey run POS business.

E spend six months for hospital bed sake of di accident but unfortunately dem later cut im lower arms for hospital.

As e dey narrate how e lost im arms, Deejay Bankyroy tell BBC News Pidgin say di incident happun for one rainy morning for September 2023, wen e wan arrange im POS umbrella, na im di umbrella accidentally touch di high-tension cable wey dey di area and di next place e open im eyes na for hospital bed.

"Na on September 13, 2023. Di second day afta Mohbad die. I dey follow pipo charge for garage, den I later attach POS," Deejay Bankyroy tok.

"Di girl wey dey work for me, di umbrella wey she dey use take shade for outside, she no really place di umbrella well, so, I wan come go do di umbrella well, I no come know how di umbrella take connect to high-voltage wire so I come dey electrocuted, light carry me."

Deejay Bankyroy say for di six months e dey for hospital na so-so pain e dey feel for im hand hand and leg wen e wake up.

E decide make dem cut im lower arms but im parent no still gree say na only flesh remain dia, muscles and bones no dey again. Dem still try make im dey use im hand but afta so much pain dem finally carry out di surgery and cut am.

As e dey struggle wit di reality of living everyday witout im lower arms - to brush teeth, wash cloth, eat food - Deejay Bankyroy decide say e go use di criticism on top social media to make im decision say e go start to DJ work.

Di confidence to stand in front of pipo to begin work as DJ no first dey but e gada courage to begin play in front of di crowd. Even wen pipo bin dey say na mixtape im dey use play for party, e no mind dem, e just increase practice so e go get beta for di craft.

"Pipo come dey tok for comment section say you don see pesin wey no get hand wey dey do DJ? Na Wale Turner na im sing am," e tok.

"I come tell dem say na dat DJ I wan come dey do. I come dey reason am, bicos I no learn DJ right from time na POS I dey run. At first, if I dey play pipo go tok say na mixtape dis guy dey play.

"How pesin wey no get hand go dey play. At di start e just weak me, anytime wey I wan play like dis dem go tell me say na mixtape I dey play. Wetin I go come do, sometimes if I come dey play like dat, I go come dey post am for my page."

Deejay Bankyroy say e still dey reason am to open im own game house later in di future but e still like as im DJ profession dey progress and e know say God no go allow am suffer depsite im condition.

"Me wey I dey use hand bifor, na God dey watch out for me, wen I no come get hand na God go later watch out for me. I no fit no get hand make I come dey suffer. God go make way, I go dey okay.

"I no go dey beg like oda pipo wey no get hand wey go dey beg, dat one no dey for my mind bicos I believe say na God dey run am," e tok.