Campaign for di October 12 presidential election for Cameroon don officially start, as plenti candidates don begin hold rally for different parts of di kontri but 92-year-old President Paul Biya no dey among dem.
President Biya on Saturday 27 September post AI-generated video on im official X handle to market imsef as e tell kontri pipo wetin im administration don achieve.
As presidential candidates dey waka dey meet dia supporters and try win new voters, President Paul Biya no dey ground.
E bin fly go Europe for wetin dem call short private stay, just few days bifor campaign start.
Meanwhile, govment ministers don dey across di kontri dey campaign on di president behalf.
Bifor di election, one of di twelve candidates, Caxton Seta Ateki, bin officially comot from di presidential race to support Bello Bouba Maigari, wey be former Biya padi from di vote-rich northern region.
“Afta I reason well and tok wit many pipo, I don decide to support di candidacy of Mr. Bello Bouba Maigari,” Ateki announce.
E tok say na sake of many calls from opposition pipo wey dey beg am make dem join bodi support one pesin wey fit challenge President Paul Biya well-well.
For im campaign speech for di capital, Yaoundé, Mr. Maigari promise say e go form govment of national unity, wey “evri bodi go fit contribute to build our kontri”.
“Time don reach to turn di page,” e tok, as e beg oda presidential candidates make dem join bodi form one strong force.
Even though Maigari and Ateki don join hand, interior minister Paul Atanga Nji don tok say di electoral bodi no go gree any last-minute opposition coalition.
E accuse some candidates wey e no call dia names, say dem dey plan to scata di election process wit street protest and fake election result.
Afta almost 43 years for power, President Biya dey present imsef as candidate of “greatness and hope”.
“Na president wey don do evritin for us since we small,” one 33-year-old ruling party supporter Yves Yombi tok for one campaign rally for Yaoundé.
“Since dem born me, na im dey dia, so na why I believe say [na im go win di election],” e add.
Even though some candidates launch campaign for di Anglophone regions wey dey face wahala, di general mood na fear becos of lockdown wey separatist fighters impose.
Di secessionists wey wan break away form their own kontri don ban any govment-organised election for di two English-speaking regions - northwest and southwest.
For two weeks, candidates go dey tell Cameroonian pipo wetin dem go do if dem win di election.
Now wey eleven candidates dey try win di heart of di 8.2 million pipo wey register to vote, analysts dey tok say di opposition failure to form strong coalition fit affect dem for di polls.
Ninety-two-year-old Biya neva lose any election bifor and many pipo believe say na im go still win.
If e win and finish anoda seven-year term, e go don rule for 50 years just one year bifor e reach 100 years old.

Présidentielle 2025.
— President Paul BIYA (@PR_Paul_BIYA) September 26, 2025
Grandeur et Espérance.
Le Septennat des Grandes Espérances. #Biya2025 #PaulBiya #Cameroun pic.twitter.com/DcJ7IPtu5H











