BBC Pidgin of Thursday, 24 April 2025

Source: BBC

Patients at risk as doctors stop work for Tamale Teaching Hospital for Ghana

Doctors for di Tamale teaching hospital for di northern part of Ghana don withdraw emergency and out patient department (OPD) services indefinitely.

Dis na afta di minster of health and oda officials wey bin visit di facility blast dem ova di poor conditions for di hospital wey don dey affect healthcare delivery.

For many years, pipo wey dey visit di hospital wey be ogbonge referral hospital for di four northern regions of di kontri, complain say di services for dia dey poor.

Pipo complain say to carry dia sick pesin to di hospital mean say di pesin go die sake of di health workers no get di equipment and oda tins to work.

Di latest incident wey make one patient die na emergency situation as di facility no get ventilator at di time of di incident.

Na so di family tok say dem no go gree say dia relative go just die like dat - di mata don blow on top social media.

Dis be why di health minister don visit di Tamale teaching hospital without announcement, to see di wahala for di facility by imserf.

Wetin health minister see for Tamale teaching hospital

During di visit of di health minister Kwabena Mintah Akandoh and im oda colleague minister, Alhassan Suhuyini togeda wit members of di health committee of parliament, dem find say some of di conditions for di hospital dey poor.

Di minister find say di facility no get water for dia washrooms and di situation bad.

Inside one viral video on top social media, one of di head of department for di hospital bin try to explain to di minister wetin happun bifore di patient die.

Im tok say dem try to do wetin dem sabi, at di time dem carry di patient come di place at di time di ventilator no dey work.

Im also tok say dem explain to di family how tins dey bifor dem carry di patient come.

But di health minister now vex afta im hear say di staff of di hospital tok say im no know why "pipo don blow dis mata out of proportion."

Dis na wetin cause di health minister Kwabena Mintah Akandoh and di deputy roads minister Alhassan Suhuyini to blast di staff.

"Why una dey tok to me di minister dis way? Di way you don dey carry your serf bifor me and how una dey tok dey show how you dey treat patients wey come here," oga Akandoh and Suhuyini respond.

Di minister tok say im sabi say di staff no dey di equipment to do dia job well, but dem fit to "be tolerant wia dem gat to respect patients."

Di minister also question di medical director why some of di equipment like di MRI, CT scanners, ventilators and endoscopy machines no dey work.

Na so di CEO of di hospital, Dr Atiku Adam explain say "some of di machines no dey work since dem carry dem come di hospital, even bifor I become CEO."

Di health minister now tok journalists say "we go investigate di mata and audit all di equipment wia dem supply wey no dey work. We go also explore private partnership to get new equipment for di hospital so say di staff fit to do dia job."

About di case wia di patient don die, di CEO tok di minister say "we don set committee to chook mouth for dis mata and find di circumstances under which di patient don die."

Di health minister also tok say im go work wit oda sector ministers to provide water for di hospital to deal wit dia water wahala.

Goment sack di CEO of di Tamale teaching hospital

Later dat day, afta di health minister bin visit di hospital, di health minister announce say di president don sack di hospital CEO.

Tori from di presidency na say dem sack di CEO sake of "managerial negligence" and oda tins.

Tamale teaching hospital doctors withdraw emergency services

Afta one meeting by di doctors for di tamale teaching hospital when di minister bin visit di place; dem gree to withdraw dia services.

Inside one statement, di doctors tok say dem no like di way di health minister and oda ministers bin shout on top dia staff di time dem visit di hospital.

Na so dem decide say dem go withdraw emergency and OPD services until di health minister go apologize to dem.

"Wit immediate effect, all members of doctors association of Tamale teaching hospital, go suspend dia service indefinitely for OPD, antenatal, specialist clinic and paediatric OPD."

For now patients don dey stranded for di hospital as di doctors begin dia strike.

Young and old pipo wey visit di place Thursday morning dey sit outside for hours as no doctor dey at post.

"We neva hear about dis strike, na hia we come wey dem dey tok us say dem no dey work," one patient Awudu tok journalists.

Women wey carry belle, and odas wit dia pickins all bin dey stranded for di OPD.

But di doctor say until goment go gree to do wetin dem dey ask and di health minister go apologize to dem, dia strike go kontine.

Di Ghana medical association chook mouth for di mata

Di Ghana medical association wey be di umbrella body for doctors for di kontri don support dia colleagues for di Tamale teaching hospital.

Inside one statement wia di secretary Dr Richard Selormey don sign, di GMA say dem "condemn di treatment of di doctors for di emergency unit when di minister of health don visit di place."

Di GMA also "condemn di sacking of di hospital CEO Dr Atiku Adam as dem neva follow due process wia e be abuse of power by di health minister."

Di GMA "dey stand in solidarity wit our colleagues for Tamale on top dis mata. Dis na injustice."

In di meantime, president Mahama don appoint anoda pesin as CEO for di Tamale teaching hospital.

Dr Abubakar Bawah Abdulai don take ova from Dr Atiku Adam wey dem appoint as CEO for November 2022.

Di new CEO na senior official for di university for development studies (UDS) wia im dey take ova afta di kasala between di health minister and staff for di hospital.

Di opposition new patriotic party (NPP) don already condemn di sacking of di CEO wia dem tok say di president gat to re-instate Dr Atiku.

But goment explain say di sacking of Dr Atiku bin dey di pipeline already as part of di goment plan to improve di management of healthcare facilities.

How important be di Tamale teaching hospital

For dis strike wia di doctors for di hospital don start, e go affect healthcare for di area.

Di hospital na di primary tertiary care provider for di savanna, northern, upper east, upper west, north east regions wia im also dey take care of some parts of di Bono and Volta regions.

Some pipo even dey comot neighbouring Burkina Faso and Togo to get healthcare for di Tamale teaching hospital.

Along di middle belt of di kontri, wia tricycle and motorcycle na di main source of transport, di tamale hospital dey receive plenty accident and emergency cases from road accidents.

The hospital wia dey operate for ova 50 years na 812 bed capacity, wit 60 clinics and average of 340 patients a day, according to informate for dia website.

Di hospital also bin get 3,133 staff.


Di health minister and oda goment officials bin visit di facility wia dem find say tins no dey go on well for dia




pressure dey on top di health minister Kwabena Mintah Akandoh to apologize to diu doctors for di Tamale teaching hospital afta di gbas gbos wit staff during im visit



MRI, CT Scan machines, ventilators and oda equipment for di hospital no dey work




Water no dey flow for di washroom; some staff of di hospital dey use dia moni to buy water for di facili




Di goment bin sack Dr Atiku wey be di CEO for di hospital since November 2022