Di Redeemed Christian Church of God (RCCG) wey be one of di largest Pentecostal Church for Africa don clear di air on wetin dem call "false narratives" wey dey spread about di Church and di General Overseer Pastor Enoch Adeboye.
Di Church say tori say RCCG bin campaign for di ruling All Progressives Congress (APC) govment no be true.
RCCG Public Relations Unit for one statement on dia official X account on Tuesday clear am say Pastor Adeboye instead dey always encourage members of di RCCG to collect dia Permanent Voters Card and vote for anyone of dia choice.
Recently, di church bin enta public eyes as some Nigerians drag dem ontop one alleged planned protest wey dem cancel and di call for di removal of Nigeria First Lady Remi Tinubu as Pastor for di church, plus oda allegations.
Di church don respond to di accuse and add say: "Pastor Adeboye and di RCCG no go dey defined by falsehood, and di Church no go remain silent while inaccurate narratives dey repeatedly circulated as facts."
Pastor Adeboye cancel planned protest
Recently, tori bin spread say di 84-year-old General Overseer bin cancel one protest against insecurity for di kontri and di kidnap of school children for Oyo state.
RCCG say dat no be true as wetin di cleric tok about di rally na di instruction wey di Pentecostal Church of Nigeria (PFN) give to all di churches wey dey under am.
"Pastor E.A. Adeboye bin only communicate di instruction of di Pentecostal Fellowship in Nigeria to members of di RCCG on di updated plan to get di grand finale of di three-day prayer programme for one centralised venue and hold rally around di venue."
Many pipo don drag di GO say e lead and carry placard and protest against di administration of former President Goodluck Jonathan but for insecurity issues during President Bola Tinubu administration, e no organize im members to protest against am.
The walk in
Di church explain am say di walk for Ebute Metta, wey Pastor Adeboye participate inside na part of dat nationwide exercise. Di church no organize am against President Goodluck Jonathan and e no in anyway dey connected to im administration.
Di GO bin also hold peaceful nationwide walk in response to di directive wey di Christian Association of Nigeria (CAN) issue during di administration of di late President Muhammadu Buhari.
"Churches across Nigeria bin dey instructed to hold peaceful walks afta service, to call di attention to of di govment to di persistent killings of Christians and urging dem to take decisive action to protect lives", di statement add.
Pastor Adeboye intentionally dey quiet on di things wey dey happun for Nigeria
Di Church also dismiss allegations say Pastor Adeboye intentionally dey silent on developments for di kontri.
Pastor Adeboye na one cleric wey dey vocal on national issues and dey always call govment attention to things wey no dey go on well for di kontri. But, recently pipo don accuse am say e turn blind eye to Tinubu administration. Some allege say weda na becos dem come from di same ethnic group or becos di President's wife na Pastor for di church.
Di Church for di statement clear am say di cleric on several occasions, don publicly address issues including insecurity, corruption, economic hardship, elections, governance, plus di need for righteous leadership.
However, most times, e dey choose di language of moral guidance, prayer and counsel, instead of partisan political confrontation.
On di removal of Nigeria First Lady Oluremi Tinubu as pastor for Redeemed Christian Church of God, Pastor Adeboye say di church no go remove her from her position as she be ordained pastor for di church.
Di cleric wey give dis informate for di May Holy Ghost Service, Adeboye explain say di First Lady dey ordained as an Assistant Pastor more dan ten years ago, long bifor husband, Bola Ahmed Tinubu, show any intention say im wan run for di presidency.
E clear am say di First Lady go through di full process of ordination and she no violate any of di church guidelines, as e add say di church no go bow to external pressure wey dey call for her removal.
The lies have gone on long enough. It stops now!!!
— RCCG PUBLIC RELATIONS (@RCCG_PR) June 2, 2026
For far too long, Pastor E.A. Adeboye and The Redeemed Christian Church of God have been subjected to false narratives, deliberate misrepresentations, and misleading commentaries driven by personal interests and agenda setting. pic.twitter.com/xksub3TZEJ











