You are here: HomeAfricaBBC2023 10 30Article 1871690

BBC Pidgin of Monday, 30 October 2023

Source: BBC

PRESEC, Opoku Ware and Achimota school battle for grand finale of Ghana National Science and Maths today

Di national science and maths quiz trophy Di national science and maths quiz trophy

Ghana President Nana Akufo-Addo be one of di ogbonge pesin wey dey attend di grand finale of one popular senior high school quiz competition for di national theatre.

Three schools don dey battle each oda for di trophy wit di bragging rights at stake for dis year national science & maths quiz (NSMQ).

PRESEC and Achimota school wey dey Accra go meet Opoku Ware school wey dey from Kumasi.

Di NSMQ dey happun for thirty years, but di competition don hype recently sake of di heavy social media engagement and involvement of di schools wey dey participate.

For di past four weeks, dem dey do di contests from di preliminary stage come reach di final.

'Semi-final contest bring wahala'

Di organizers dey allow say some of di schools fit protest if dem feel say di quiz mistress allow or disallow some answers.

Na so one school, Prempeh College from Kumasi don raise issue wit one answer di quiz mistress accept wey make di school chop second for one of di two semi-final contests.

Di winner of dat contest be Opoku Ware wey go di final wit two points.

Prempeh College write to di organizers of di NSMQ say one of dia answers for di last round of di contest be correct wia di quiz mistress disallow am.

Di NSMQ explain say sake of di riddle round dey require specific answers based on clues dem dey give, di quiz mistress dey expect specific response, wia im go fit use im discretion.

Na so im decide to reject di Prempeh College answer wia make dem lose di 19 October contest by just two points.

Despite di explanation, Prempeh College maintain say di quiz mistress for accept dia answer.

One of di old students of di school don go court sef, to file injunction on di grand finale until di high court go determine whether dem get case.

But since some part of di writ trend for social media, di organizers no talk if e go affect di 30 October grand finale.

Di three schools wey dey vie for di trophy

PRESEC be seven-time winners of di national science & maths quiz competition, wia dem win am last year.

Dis be dia fifth consecutive final for di competition.

Di school be one of di top senior high schools for di kontri wia dem dey do well for plenti competitions.

Dem also be Greater Accra regional champions of di same contest.

Di oda school, Achimota Senior High School wia dey Accra, don win di competition two times.

Di school dey boast of di fact say dem produce four heads of state for Ghana.

Opoku Ware be di last of di three finalists.

Dem also win di competition two times before.

Di school dey di Ashanti region wia ibi one of di best schools for di kontri.

So far, no all-girls school win di competition for di thirty years di NSMQ dey run.

Wesley Girls High school and Mfantsiman Girls school be di only all-girls schools wey reach di finals before.

Wetin dey at stake for di finale

Di winning school go get one shiny trophy.

Dem also go get cash prizes and oda products and service support from di sponsors.

Di school go also get di bragging rights for one year until di next edition in 2024.

Some of di contestants from di NSMQ over di period don get scholarships wia odas dey fit get opportunities to study abroad.