BBC Pidgin of Wednesday, 6 August 2025
Source: BBC
Nigeria former president Goodluck Jonathan don dey mouth of pipo wey dey look weda di opposition party, Peoples Democratic Party (PDP), dey consider am ahead of 2027 election.
Dis na afta different social media posts and comments dey mention Goodluck Jonathan name say e dey look to put head for di next election.
Oga Jonathan wey be di president of Nigeria between 2010 and 2015 bifor Muhammadu Buhari defeat am for 2015 election wia e concede even bifor Inec announce di election result, na one big name for Nigeria political scene.
Meanwhile, as di tok about 2027 election don dey spread for different political parties, eyes dey for who go be candidate for di leading opposition party, PDP, afta one coalition wen dem name African Democratic Congress (ADC) bin form dia party national committee.
For August 2025, one verified Instagram account wit di handle @goodluck_ebelejonathan bin post one foto wey get di face of former President Jonathan. Di handle come add di caption "2027, we shall overcome bad luck and bring good luck."
Dis post make Jonathan followers dey ask weda e dey consider to run for 2027. Den di handle reply for comment say "If I dey contest to be president, I no need to make promises, you sabi wetin I dey capable of."
From dia, different social media posts begin dey attach di name of Oga Jonathan to 2027 election, say di PDP wey be im party dey look dat direction.
But di rumour say di former Nigeria president dey eye 2027 candidacy under PDP na true?
Jonathan dey contest for 2027?
BBC News Pidgin reach out to di PDP to hear from dia side wetin di rumour of di former president Jonathan be for di party.
Di party say dem neva hear or see dat kain rumour as wetin di party dey focus on now na how to elect dia national leaders.
National Publicity Secretary of PDP, Hon. Debo Ologunagba tok say di party get dia process and if dat kain information dey say pesin dey wey dem dey consider ahead of 2027 election, dem go let di public know through di 'normal way'.
We ask am if e don see di social media tok say PDP dey consider Oga Jonathan for 2027, Ologunagba say e dey hear dat for di first time, and if dat kain tin dey, e go follow di correct process.
"Since you say na rumour, you no fit confam dat, Our party get way, we get our process and if dose information dey available we go push am out for di normal way. I dey hear dat for di first time," Ologunagba tok.
PDP National Publicity Secretary say di party go follow due process and also follow dia constitution if any tin, but now dem dey focused on how dem go elect new party leaders.
"If new development go dey, dis party go follow due process. We be party of order and process, we no be party of rumours, we get our constitution, we get our process and we get rules and guidelines. We get convention to elect national leaders of di party."
Ologunagba add: "Na rumour and we no dey rely on rumour, I no even dey aware, e go remain for di realm of rumour. For clarity sake, we dey focused on di agenda of di party wey be di election of new leaders for di party. E go dey wrong to say I debunk am, I no dey aware, we get process."
<>Goodluck Jonathan still dey PDP?
Meanwhile, Oga Jonathan party make am clear say e neva comot from di party as dem no receive any letter of resignation from am.
Ologunagba for im tok wit BBC News Pidgin for phone tok say di former president no go hide am if e no be member of PDP again.
"Membership of di party na voluntary and if anybodi go comot di party, e get process to follow.
"By resignation, Ebele Goodluck Jonathan neva indicate say im no be member of di party, as to my knowledge. E dey clear, if e no be member of di party again, e go tok am," Ologunagba tok.
E say former president Jonathan neva comot from di party, but rumour say di party dey consider am for 2027 election no be true.
Meanwhile, for December 2020, former leader Jonathan say im political opponents bin judge am wrongly bifor di 2015 election wey affect im election success under di PDP.
E tok dat one for di presentation of book title "Dear President Goodluck Jonathan- wey Bonaventure Melah write to honor am. And since afta di 2015 election, Goodluck Jonathan don move on to hold different global positions, including mediator for West African regional bloc, Ecowas.
Bifor now, for 2021, rumour bin fly up and down say Oga Jonathan wan join di ruling All Progressives Congress (APC) but di PDP sharply debunk am say e no drop any resignation letter to comot di party.
Goodluck Jonathan and im political career
Dem born Goodluck Jonathan for November 20, 1957 for Otuoke Ogbia Local government area of Bayelsa state to di family of Lawrence Ebele Jonathan, canoe- maker and Eunice Ayi Ebele Jonathan, retired farmer.
E attend St. Stephen's Primary School, Otuoke; St Michael's Primary School, Oloibiri and Mater Dei High School, lmiringi Ogbia.
Jonathan later attend University of Port Harcourt, Rivers state wia e receive Bachelor of Science degree, Master's degree and Doctorate in Hydrobiology and Fisheries Biology.
GEJ Political career
Goodluck Jonathan political career start wen e become di Deputy Govnor of Bayelsa state to di den govnor Late Diepreye Alaimeyeseigha for 1999.
Sake of some Political matter, dem swear Jonathan in as Govnor of Bayelsa state for December, 2005.
Two years afta, during di governorship campaign for 2007 di Peoples Democratic Party [PDP] select GEJ as di Vice presidential candidate of Umaru Musa Yar'Adua.
For 2010, Jonathan become Nigeria president afta Yar'Adua sake of bad health.
Former President Jonathan for 2011 contest for presidency and e win.
Im hold di office till 2015 wen im lose to late President Muhammadu Buhari.
Today former President Goodluck Ebele Jonathan don become peace ambassador sake of how e take concede defeat to im opponent, di late President Buhari.
