BBC Pidgin of Wednesday, 17 December 2025

Source: BBC

Ousmane Dembele win Fifa Best Award 2025

The Best Fifa Men's Player winner, Ousmane Dembele on stage with di trophy The Best Fifa Men's Player winner, Ousmane Dembele on stage with di trophy

Paris Saint Germain and France forward Ousmane Dembele don win di Fifa Best Men's Player for 2025.

Ousmane Dembele beat ogbonge nominees like Achraf Hakimi wey dey play for Morocco and PSG, Harry Kane of England and Bayern Munich, Kylian Mbappe of France and Real Madrid.

Dembele bin struggle for form during di first half of di 2024-25 campaign but im pick afta dem change im position to central forward.

Im score eight of di 35 goals for di Champions League last season, including crucial strikes against Liverpool and Arsenal for di knockout stage.

In total, im score three goals and provide three assists for PSG across all competitions dis term.

For di international stage, Dembele help France qualify for next di World Cup, wia di two-time winners go face Senegal, Norway, and one of di play-off winners for di group stage.

Barcelona and Spain midfielder Aitana Bonmati win di Fifa Best Women Player too.

Aitana Bonmati afta dem give her di trophy tok say "I dey grateful to get di honour. na sake of all di players, coaches and di fans, I dey enjoy."

For di women category, Spain don continue to dominate ova di years, some past winners include, Marta wey win for 2018, Megan Rapinoe for 2019, Lucy Bronze for 2020, Alexia Putellas wey win for 2021 and 2022.

Dis award make am di third time wey Aitana Bonmati go win am.

She win for 2023, 2024 and 2025.

Luis Eric win Best Coach for 2025

Luis Enrique wins di Best Men Coach for men and na Arsene Wenger make di announcement.

Di PSG boss beat ogbonge coaches like Javier Aguirre of Mexico, Mikel Arteta of Arsenal and Hansi Flick of Barcelona to win di award.

Oda nominee na Enzo Maresca of Chelsea, Roberto Martinez wey dey coach Portugal and Arne Slot of Liverpool.

England manager Sarina Wiegman win di Women category.

Sabrina wey bin no dey physically present say "Na absolute honour to receive dis award again..."

Donnarumma win goalkeeper of year award

Manchester City goalkeeper Donnarumma win di Fifa Men goalkeeper of di year for 2025.

Di Italian shot-stopper, wey dey 26 years play ogbonge role as PSG win di Champions League last season bifor dem move to di Etihad Stadium last September.

Donnarumma, wey keep clean sheet for di final against Inter Milan for May, finish ahead of Premier League goalkeepers Alisson Becker, Emi Martinez, David Raya and Real Madrid's Thibaut Courtois as e win di award for di first time.

Donnarumma also help PSG win Ligue 1, Coupe de France and di Trophee des Champions titles during di 2024-25 season.

Montiel stunner win Puskas Award

Independiente winger Santiago Montiel win di Puskas Award for di classy overhead kick wey im bin score against Independiente Rivadavia for Argentina Primera Division.

Di 25-year-old incredible acrobatic effort dey enough to give im side 1-0 win for his for in May.

Montiel, wey be di second successive Argentine to win di award afta Alejandro Garnacho in 2024, say: "I no even tink about am, I just hit am."

Arsenal and England midfielder Declan Rice bin dey di shortlisted for di award for di second of two free-kicks wey im scored against Real Madrid for di Champions League quarter-final first leg.

Fifa Best XI

African Player of di Year 2025 Achraf Hakimi join Gianluigi Donnarumma

William Pacho, Virgil van Dijk and Nuno Mendes to make Fifa Best team for 2025.

Odas na Cole Palmer, Jude Bellingham, Vitinha, Pedri

Lamine Yamal and winner Ousmane Dembele.

Last year Ederson, Carvajal, Rudiger, Van Dijk

Bellingham, De Bruyne, Kroos, Rodri, Haaland, Mbappe, and Vinicius Jr make di team of di year.

Men players wey don win am bifor

Some of di ogbonge players wey don win am bifor include

2016 - Cristiano Ronaldo

2017 - Cristiano Ronaldo

2018 - Luka Modric

2019 - Lionel Messi

2020 - Robert Lewandowski

2021 - Robert Lewandowski

2022 - Lionel Messi

2023 - Lionel Messi

2024 - Vinicius Junior