Di main opposition party for Ghana dey protest wetin dem describe as "harassment and abuse of power" by di John Mahama govment, nine months since dem win elections.
According to di New Patriotic Party (NPP), di govment dey use police and national security to intimidate dia members.
Di recent case involve di Bono Regional chairman of di party Kwame Baffoe alias (Abronye DC) on 8 September.
Police charge di party executive wit 'offensive conduct and publication of false news'.
Police detain am bifor one court for Accra remand am into custody for one week.
For May dis year, di Economic and Organized Crime Office (EOCO) arrest Ashanti regional chairman of di party - Chairman Wontumi.
Dem detain am ova alleged corruption cases and some contracts wey he get under di ex-Nana Akufo-Addo govment.
State security say he get plenty questions to answer.
Also only last month, police confam di arrest of two TikTokers - Prince Ofori (alias Fante Comedy) and Yayra Abiwu (Akosua Jollof) say dem threaten di president and im wife on di social media platform.
According to police, dem also dey find odas wey dey connected to di viral video recording and pipo wey share am.
Inside one statement on di mata, di opposition NPP tok say "di arrest of dis pipo be attack on free speech."
"Dis arrests be shamelessly biased and undemocratic."
Di protesters dey demand say make di police stop wetin dem describe as "politically motivated harassment through arrests, demands and investigations of target opposition figures."
Govment say dem neva abuse dia power despite di allegations of di opposition party.
According to dem all di pipo wey dem arrest get questions to answer - some of dem dey allegedly involve for corruption, odas dey incite violence while some too dey publish hate speech for social media.
During di recent presidential encounter wit di media, President John Mahama warn say di security agencies "go trace and find pipo wey dey use hate speech for TikTok and social media, to incite violence."
"Pipo dey use hate speech to trigger pipo to engage in conflict and oda tins, so di national signals bureau go use di IP address of pipo to trace dem and deal wit dem," president Mahama tok.
Despite dis, di opposition party say dem go resist any attempt to stop dem from sharing dia views about di current govment.
For dis demo, party leaders, opposition lawmakers for parliament and oda sympathizers dey march to di police headquarters and di seat of govment to present petition to dem.

Despite di claims by di opposition say di state dey harass dem, govment say di security agencies dey do dema work
FILE - Di New Patriotic Party say di Mahama govment dey use di police and national security to intimidate and harass party members












