Dis one year old boy don turn local celeb afta tori comot say im bite poisonous cobra snake to death for July 24.
Little Govind Kumar bin dey play for im family garden for Mohchi Bankatwa for Bihar state India, wey dey close to border wit Nepal wen im see di snake.
"Im mama bin dey work for di back garden,' na so im grandma Matisari Devi tok.
"E catch di snake and use teeth bite am. We come notice say na cobra snake" na so
Govind loose consciousness dat time, im family rush am go local hospital.
"Wen we admit di child, im face bin swell up especially im mouth side," na wetin Dr Kumar Saurabh tok. Im be di doctor wey treat Govind for Goment Medical College for Bettiah wey be capital of Bihar.
E tok say dat same day im also treat anoda pikin wey cobra snake bite. Say both pikins now dey healthy.
Dr Saurabh explain say though di two cases dey harmful to humans, one dey much more dangerous.
"Wen cobra bite human, im venom dey enta human bloodstream and cause neurotoxicity wey dey affect our nervous system. Dis fit lead to death," na so e tell BBC.
"Wen humun bite cobra, di poison go reach our digestive system. Di human body go neutralize am and di poison go pass through." Na wetin Dr Saurabh tok.
E add say e for dey worst if to say di pikin get bleeding points for im digestive tract.
India na home to nearly 300 snake species and more dan 60 of dem get venom and cobra dey considered as one of di most dangerous among dem.
Dem don mark di kontri as 'di snakebite capital of di world" and di rate of death by snakebites don increase due to di Monsoon season.
World Health Organization (WHO) estimate say around 81,000 to 130,000 pipo dey die sake of snake bites worldwide evri year.
Between 2000 and 2019, average of 58,000 pipo dey die of snake bites for India per year according to WHO.
But di number of deaths wey snakebite cause for di kontri still dey widely underreported sake of lack of access to medical care for areas wia di incidents dey happun, according to India Ministry of Health and Family Welfare.

Doctor tok say to bite snake fit dey less harmful dan for snake to bite pesin.











