BBC Pidgin of Monday, 11 August 2025

Source: BBC

One month-old baby die from 'sever bleeding' afta FGM - Police

One one-month-old girl pikin don die sake of suspected Female Genital Mutilation One one-month-old girl pikin don die sake of suspected Female Genital Mutilation

One one-month-old girl pikin don die on reported complications from suspected Female Genital Mutilation, The Gambia police tok.

Di police for statement say two women wey allegedly get hand for di mata now dey for police custody as di police for Wellingara.

Dem tok say, "initial findings show say di pikin bin dey allegedly subjected to circumcision and later come start to get serious bleeding.

"Dem come rush am go Bundung Maternal and Child Health Hospital wia dem pronounce am dead on arrival".

FGM dey illegal for di Gambia and even as recent as last year, parliament slap down attempt to comot di law wey make am illegal.

According to di law, di pipo wey do di FGM fit face up to three years for prison but di mata don turn to life sentence if di girl die becos of am.

Reactions don come from different sides about dis tori wey di police release.

Human rights group Edward Francis Small Centre for Rights and Justice, comment on di police statement.

Dem hail di arrest of di suspects say e go make oda pipo wey wan run dis kain parole stop and tink.

Dem tok say, "we dey call on di ministry wey dey responsible for children to ginger increase public awareness and monitoring and enforcement of di law so dis kain tin no go happun again".

Meanwhile anoda NGO group, Women In Leadership and Liberation (WILL) accuse di authorities say dem fail to protect children .

Dem add for statement say, "culture no be excuse, tradition no be shield, dis na violence, pure and simple".

Fatou Baldeh wey be WILL Founder tell BBC say, "Parents feel like if dem cut dia girls as babies dem go heal sharparly, also bicos of di law e go dey easier to disguise so pipo no go know".

For July 20204, di Gaambia lawmakers reject bill wey bin wan do u-turn on di 2015 ban on FGM.

Dis na afta human rights groups and UN ginger di MPs to block di bill wey land di parliament bicos of ginger by some MUslim clerics.

Na onr Almameh Gibba table di draft law come and wen dem first introduce am majority of di MPs approve, wey for mean say Di Gambia for be di first kontri to do about turn on di FGM mata

But dem no gree for second reading, so dem no even bother to take am to third reading, e just kpai for dia.

Di Gambia dey named among di top 10 kontris wit di highest rates of FGM wia 73% of women and girls between di ages of 15 and 49 don face am, according to di United Nations.

Amnesty International add say, three in evri four girl pikin for di kontri dey do dia own FGM bifor di age of six.

For di most severe part of di FGM, afta dem comot di clitoris and dem cut di genitals dem cut and stitch am close so di woman no go fit knack or enjoy di knacking.