You are here: HomeAfricaBBC2024 04 10Article 1925462

BBC Pidgin of Wednesday, 10 April 2024

Source: BBC

Ogbonge Nollywood actor Junior Pope die at di age of 39

Junior Pope Junior Pope

Ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo wey pipo sabi as Junior Pope don die at di age of 39.

Junior Pope die for boat accident on Wednesday 10 April for Asaba, Delta State, south-south Nigeria, Actors Guild of Nigeria (AGN) president, Emeka Rollas confam to BBC News.

Witnesses wey dey di scene tok say Junior Pope and four oda pipo go shoot for Asaba but di boat wey dem carry get accident for River Niger.

"True, Junior Pope die for Asaba today, for boat accident. We don carry im body go mortuary in Asaba.

"Four oda pipo na victims but dem neva find dia bodi," Rollas tok.