You are here: HomeAfricaBBC2021 04 04Article 1223992

BBC Pidgin of Sunday, 4 April 2021

Source: BBC

Obasanjo, Gumi meet for Abeokuta, want make FG create special courts for bandits

Former Nigeria president Olusegun Obasanjo Former Nigeria president Olusegun Obasanjo

Former President Olusegun Obasanjo on Sunday hold meeting wit di popular Northern Islamic cleric Sheik Ahmad Gumi alongside some oda leaders from di region for im house wey dey Abeokuta, Ogun state.

For inside one statement wey dem jontly sign at di end of di meeting wey hold behind close doors, dem advise di Federal goment of Nigeria to create special courts to deal wit cases of banditry, kidnapping, ransom demanding and unlawful carrying of fireman.

Dey also want make goment rehabilitate, empower and also give job to any bandit wey want comot bush and crime.

According to Obasanjo and Gumi, evri pesin must stop to dey ethnicise and regionalise crimes.