Russian officials say 48 pipo na im die wen one Angara Airlines plane go down for one thick forest for di far-eastern region of Amur.
Di Antonov An-24 plane, wey carry 42 passengers and six crew bin comot for Blagoveshchensk close to di Chinese border and just disappear from di radar screens as e dey approach Tynda airport, officials tok.
Russian civil aviation helicopter den see fuselage wey dey burn from di plane on a remote hillside about 16km (10 miles) from Tynda.
Amur regional governor Vasily Orlov say five children dey among those on board and e don declare three days of mourning.
Di remote swampy nature of di area mean say rescuers dey take about one hour to reach di plane wia e happun.
According to emergency officials, preliminary inquiries dey chook eye for either pilot error or poor weather conditions or technical malfunction.
Di An-24 plane bin dey on im final leg of di route from Khabarovsk for far south-east of Russia.
Low cloud bin dey wen di plan crash and di plane bin don already make attempt to land for di airport wey fail. Na wetin emergency services tok.
Dem add say dem bin lose radar contact wit di plane wen di crew bin dey prepare to try to land again di second time.
Angara Airlines base dey for di Irkutsk region of Serbia and all di crew members come from di Irkutsk region.
Some of di passengers dey work for Russian Railways for di far east.
Di Antonov 24 plane dey almost 50 years old and na for Kyiv dem originally design am during di Soviet era., although dem bin neva use dis model for Ukraine for many years.
Di officials say di plane bin pass one technical inspection wey dem do recently, but di civil aviation authority tell news agencies say di plane bin don get four incidents since 2018.
Di left wing bin spoil seven years ago wen di plane run pass di run way go hit one lightening mast, na wetin Tass news agency tok.
Oda An-24 planes bin get fatal crashes too.
One An-24RV comot from runway as e bin land for Nizhneangarsk Airport for July 2019.
Two members of di flight crew die.
For 2011, anoda Angara An-24 crash enta di Ob river for Siberia, e kill seven passengers.
Afta di 2011 crash, di President at time. Dimitri Medvedev bin tok say An-24 make dem ground all di An-24 planes wey dem bin still dey use.











